Charlie Hebdo: Magazine republish Prophet Mohammed cartoons wey lead to terror attack for 2015

A women wearing a mask reading "I am Charlie"

Reuters

Fourteen people dey face accuse for court of law for France sake of di deadly attack wey dem publish inside one satirical magazine Charlie Hebdo more than five years ago.

Most of di pipo wey dem claim say get hand for di mata dey court for Paris, but three of dem dey tried in absentia.

Dem dey accuse dem say dem help militant Islamist attackers wey shoot to death 12 pipo in and around Charlie Hebdos Paris office for January 2015.

Di third gunman shot one policewoman and she die and dem also attack one Jewish supermarket.

In total, 17 pipo die within just three days.

French satirical magazine Charlie Hebdo bin republish cartoons of di Prophet Mohammed wey make dem di target of one deadly terror attack for 2015.

Dis republication dey come one day before 14 pipo wey dem accuse say help two Islamist attackers carry out dia gun rampage on 7 January, 2015 dey go on trial.

Twelve pipo die, including famous cartoonists. Five pipo die inside related attack for Paris days later.

Di attacks start jihadist attacks across France.

Wetin dem publish?

Di front cover of di latest edition feature di 12 original cartoons of di Prophet Mohammed, wey Danish newspaper bin publish before e appear inside Charlie Hebdo. One of di cartoons show di prophet dey wear bomb instead of turban. Di French headline read “Tout ça pour ça” (“All of dat for dis”).

For dia editorial, di magazine say pipo bin don dey ask dem say make dem continue to dey print caricatures of di prophet since di 2015 killings.

“We don always refuse to do so, not because e no dey allowed, – di law allow us to do so – but because good reason bin no dey to do am, reason wey get meaning and wey bring something to di debate,” e tok.

“To reproduce dis cartoons for di week di trial over di January 2015 terrorist attacks dey open be like something wey dey essential to us.”

Courtroom wia di trial against di alleged accomplices for di Charlie Hebdo attack go happun for Paris

EPA
Di trial of di alleged accomplice dem open on Wednesday

Wetin dey expected for di trial?

Fourteen pipo dey accused say obtain weapons and provide logistical support for di attackers of Charlie Hebdo Paris offices, and oda attacks on one Jewish supermarket and one police officer.

Di Hyper Cacher grocery store for Paris suburb, 7 January 2020

EPA
Di Hyper Cacher supermarket, wia one gunman kill four pipo for January 2015

Dem dey try Three of di accused in absentia as dem believe say dem run go northern Syria and Iraq.

Di believe na say like 200 pipo wey bring legal action, plaintiffs, dey di trial and survivors of di attacks dey expected to testify, France RFI broadcaster report.

Di trial bin suppose start for March but dem postpone am because of di coronavirus pandemic. E go last until November.

Wetin happun for 2015?

On 7 January, brothers Said and Cherif Kouachi storm di offices of Charlie Hebdo, and open fire, dem kill di editor Stéphane Charbonnier, wey pipo sabi as Charb, four other cartoonists including Cabu, two columnists, one copy editor, one guest wey dey attend di meeting and di caretaker. Dem also kill di editor bodyguard and one police officer.

As police hunt down di two brothers – wey dem eventually kill – anoda siege begin for di east of Paris. Amedy Coulibaly, wey know di Kouachi brothers, kill one policewoman before e take several pipo hostage for one Jewish supermarket. He kill four Jewish men on 9 January before police shoot am dead.

For one video recording, Coulibaly say di attacks na in di name of di Islamic State group.

Why dem target Charlie Hebdo?

Charlie Hebdo anti-establishment satire – wey dey yab di far right, and some aspects of Catholicism and Judaism as well as Islam – bin don dey cause controversy for some time.

But na di way dem portray di Prophet Mohammed n aim lead to death threats against di editorial team and one petrol bomb attack on dia office for 2011.

Charb bin don strongly defend di cartoons as symbolic of freedom of speech. “I no blame Muslims say dem no dey laugh at our drawings,” e tell di Associated Press for 2012. “I live under French law. I no dey live under Koranic law.”

Afta di 2015 attack, thousands of pipo enta streets to protest and di hashtag #JeSuisCharlie (I am Charlie) begin dey tren around di world.