Aisha Buhari, di wife of Nigerian president, Muhammadu Buhari don share di foto of her daughter, Hanan wedding wit Mohammed Fahd.
She share am for her instagram page wit di caption “#HamadForever Alhamdullilah”
Tori bin dey make di round for local media since August say Nigeria president Muhammadu Buhari youngest daughter, Hanan Buhari dey marry Nigeria politician, Sani Sha’aban son, Mohammed Turad.
Di wedding happun for September 4, 2020 for Aso rock.
- Nigeria billionaire daughter Adama Indimi and Prince Malik Ado Ibrahim wedding fotos and videos wey go totori you
- Why Buhari daughter fly presidential jet go do private waka for Bauchi
Wetin we sabi about Muhammed Turad?
Muhammad Turad Sha’aban na di son of Honourable Sani Sha’aban, one former lawmaker wey represent Sabon Gari, Zaria for di 5th Assembly and also na former gubernatorial candidate for 2007 and 2011 elections.
Alhaji Sha’aban na di Damburam Zazzau for di Zazzau Emirate Council.
Tori be say im Turad, na financial expert.