Kasala gas today for inside Big Brother season 5 lockdown house as di Head of House, Erica, her deputy, Prince and Neo clash with Lucy on top team selection.
Di housemates para afta Lucy no wan gree accept to join di team wey di HOH and deputy put her sake of say Kiddwaya and Erica dey dat team.
Erica wey be di Head of house tell Lucy say: “You get bad attitude, You be di problem for every team.”
Then Leo begin tell di housemates to clear Lucy and make her corporate instead of her to dey reject di group wey dem put her.
“Una no wan follow am talk, una dey condone rubbish.” dis na wetin Neo tok.
Di argument come serious sotey Prince wey be Deputy Head of House para and begin shout
“I don dey tell you dis thing ever since you waka enta do house, ever since we dey here. I be your friend, I go try to tell you wetin dey right for you. But then I no go keep quiet for your nasty attitude” Prince tok.
- Erica admit Kidd Waya wit her do ‘everitin’ for BBNaija Head of House Lounge
- How BBNaija housemates nominate Laycon, Nengi, Kiddwaya and odas for eviction inside dia first session
Lucy come dey ask prince wetin she do now? wetin she don do different dis time and dis na wetin Prince tell her;
“If you get attitude problem, make you keep am to yourself, we dey try to work on something…wetin you do different be say, you dey try to disobey di rules concerning Di task wey dem give us .
“Dem tell us to share ourselves into groups and di head of house and deputy decide to to do sharing but you decide to make your own problem our own problem.”
How fans react to di quarrel
Fans of di reality TV show dey clash sef with each oda concerning weda Lucy dey right or wrong.
Why blame Lucy for not wanting to join the losing team if na you, you go join?
— Legitbo$$ (@CFClegitboss) September 3, 2020
He’s so angry he looks scary 😭
Lucy is definitely at fault, someone that doesn’t even talk that much— i said Bims (@Bims_s) September 3, 2020
If Lucy leaves the house will be so boring. More less like a family gathering.
— Ogunsola Oluwadamilola (@lloyddee) September 3, 2020
But it’s okay that Kidd yesterday said he didn’t want to be a group with Lucy? That wasn’t a disrespect to HOH and DHOH?
— L’Okoye (@itsohbyblee) September 3, 2020
Lucy is just afraid her group might not win that’s her problem 🤷♂️
— Golden (@Golden69721150) September 3, 2020
I don’t understand why Lucy is a problem. Baby find money come you put her for group wey nor be money them dey find you say make she no japa. I can fit to understand ooo
— Omayzee Miann (@OmayzeeM) September 3, 2020
Even when Lucy is right, it will always be a case of “she’s difficult to work with”. Even when Lucy expresses herself, they come for her, which is wrong!!
Honestly the hate on Lucy is too much, just imagine Erica with nasty attitude talking trash at her.
— 𝐃𝐫 MOHNICE💉 (@Official_mohnyc) September 3, 2020
Lucy is giving us content. I believe her game is to keep up that underdog personality. Africans love the underdog. Everyone in the house and outside are just playing her game. #BBNaijia #BBNaijia2020 #bb
— Joseph Moore (@iamjosephmoore) September 3, 2020
Big brother’s house is life situation in a box. Imagine Lucy as a team member in a bank project. Let’s be fair. I am not trying to blame Lucy but Prince is right this time.
— Lily (@Lily17345883) September 3, 2020