New electricity tariffs in Nigeria 2020 hike for kilowatt unit of energy frustrate pipo from Ikeja to Abuja – See how much you go pay now & why NERC announce sudden hike

New electricity tariff wit more than 100% increase na im Nigerian must pay from 1 September, 2020.

Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) suddenly increase light bill AKA electricity tariff from 30.23 Naira for one kwh (kilowatt unit of energy per hour) to as much as 62.33 Naira per kwh.

NERC call di new electricity charges ‘Service Reflective Tariff’ go be di more hours you enjoy supply di more bill you go pay.

Di new electricity tariff in Nigeria 2020 hike for kilowatt unit of energy come into effect afta one meeting wey dem do on Monday 31 August, 2020 come direct Distribution Companies alias Discos to begin charge new tariff plan immediately.

With dis new tariff, pipo wey dey use light for 12 hours and above go pay up to 80% more but di increase no go affect poor pipo wey dey use light for less house, according to category wey di electricity regulators put.

Electricity tariffs

BBC
Dis na full details of how much electricity tariff consumers go pay across Nigeria from September, 2020

Reasons why NERC suddenly hike di tariffs

Nigerian Electricity Regulatory Commission say dem consider di following:

  • Inflation
  • Gas price
  • Nigeria’s exchange rate
  • US exchange rate
  • Average kilowatt sold by Discos
  • Unit cost of generation
  • Di aggregate technical collection and commercial loses

Dis factors, according to di NERC wey be electricity regulator for Nigeria na factors wey no dey in dia hands.

While some of dis factors bi di same nationally, some of di factor different by disco by disco. For example, di aggregate technical collection and commercial loses. Dis na di electricity wey di disco lost wen dem bin dey try collect or send to di final users.

Following dis directives from NERC, di who 11 electricity distribution companies don begin dey alert dia customers say di new price for light go dey start from Tuesday 1 September.

John Onyi of Port Harcourt City Electricity Distribution Company tell BBC Pidgin say dia PHEDC go begin network expansion to make life and power supply better for customers.

Electricity tariff
The British Broadcasting Corporation

“Di tin go worry o. Di tin no go good because already, to even pay di one we dey pay before dey worry us because of di way di economy is. So to come begin increase am now, na anoda problem be dat” One Nigeria tell BBC Pidgin.

Anoda man for Port Harcourt say di goment don too fail for electricity matter for di kontri and if dem must increase tariff, dem must to assure dem say light go dey dey.

“If light go dey dey 24 hours as dem promise us before, I believe say whatever you pay for light, to me, i believe say we will not complain much.” he add say di increment suppose dey gradual.

Dis man say im dey enjoy almost 12 hours of light for im area and if dem increase tariff, im go fit pay. However, e add say if di increase too high, e go go buy generator.

One oda pesin wey follow BBC Pidgin tok for Abuja say goment no get justification for in increment.

Sun dey set over power line

Getty Images

Dis na di new rate wey Nigerians go now dey pay for electricity

According to di minor review of multi year tariff order 2015 and minimum remittance order for di year 2020 for di distribution companies wey NERC publish for dia website, NERC setpprojection for di cost reflective tariff wey go start in 2021.

However, di service reflective tariff wey start on September 1, 2020 be di amount wey pipo go dey pay for di hours of light wey dem dey use. Di Discos don divide users into diffrent group wey dem label A to E. Dos wey dey Band A dey use 20 hours of light, B dey use 16 hours of light, C dey use 12 hours of light, D dey use 8 hours and E dey use only four hours.

According to di new regulations dos wey dey D and E no go dey affected by di new minor review. Di service reflective tarrif na di transition process wey go finally make Nigerians to dey pay cost reflective.

Di cost reflective tariff na one of di requirement for the approval of di proposed $1.5 billion World Bank loan wey di goment want collect for di power sector.

Distribution Company AKA Disco

2020 tariff for Kilowatt per hour unit of energy wey di Disco bin plan to achieve

New electricity tariff in Nigerians wey dey enjoy light for 20 hours

(Service Band A)

New electricity tariff in Nigerians wey dey enjoy light for 16 hours

(Service Band B)

New electricity tariff in Nigerians wey dey enjoy light for 12 hours

(Service Band C)

New electricity tariff in Nigerians wey dey enjoy light for 8 hours

(Service Band D)

New electricity tariff in Nigerians wey dey enjoy light for 4 hours

(Service Band E)

Yola Electricity Distribution Company

N57.4 kWh

51.12

46.46

Kaduna Electricity Distribution Company

N54.7 kWh

N56.31 kWh

54.11 kWh

50.10 kWh

38.47 kWh

33.80 kWh

Jos Electricity Distribution Company

N73.2 kWh

N50.73 kWh

N48.99 kWh

N47.21 kWh

Ikeja Electricity Distribution Company

N44.6 kWh

N53.87 kWh

N49.76 kWh

N42.73 kWh

N37.19 kWh

N32.03 kWh

Ibadan Electricity Distribution Company

N55.3 kWh

N62.33 kWh

N57.33 kWh

N53.33 kWh

N48.99 kWh

N30.39 kWh

Enugu Electricity Distribution

N54.4 kWh

N58.22 kWh

N57.09 kWh

N55.00 kWh

N49.50 kWh

N34.28 kWh

Eko Electricity Distribution Company

N47.0 kWh

N54.08 kWh

N49.81 kWh

N43.01 kWh

N40.82 kWh

N36.15 kWh

Port Harcourt Electricity Distribution Company

N62.1 Kwh

55.20kwh

54.80kwh

51.70kwh

45.20kwh

43.20kwh

Kano Electricity Distribution Company

N52.7 kWh

N58.75 kWh

N56.16 kWh

N48.09 kWh

Benin Electricity Distribution Company

N56.4 kWh

Abuja Electricity Distribution

N54.3 kWh

N49.75 kWh

N47.72 kWh

N45.69 kWh

Different stakeholders for di electricity sector don say dem no gree with dis new tarrif and fear say e fit get economic impact, according to wetin Punch Newspaper report.

Di Nigerian Electricity Consumers Advocacy Network say di increase na policy summersault as di goment only consult with few pipo for di sector before dem announce di increase. Nigeria President Muhammadu Buhari, on Tuesday, approve di implementation of di cost-reflective electricity tariff for NESI.

Di president also approve one-year waiver of 35% import tax on prepaid meters to help increase provision to consumers for accurate billing.

In June, as pipo begin see di effect of coronavirus pandemic, di kontri national assembly says dem don convince electricity distribution companies to stop di plan to increase in tariff for electricity till first quarter of 2021. Di leadership of di national assembly say di timing of di increase dey wrong sake of di pandemic and as plenty business don dey shut down.

Although di kontri don begin to reopen businesses and schools, di economy neva open fully as dem dey apply causion to aviod second wave of coronvaurs infection even as di kontri try go back to normal life.