Nigeria vs Ghana ‘trade war’ plus harassment wey Ghanaians dey show Nigerian traders and wetin we know so far

Nigeria vs Ghana situation don enta ‘delicate stage’, na wetin Nigeria foreign minister Geoffrey Onyema tell BBC Pidgin ontop di trade relations wey don tour sour between di two west African nations.

Now, House of Representatives Speaker Femi Gbajabiamila, Nigeria number four man dey visit Ghana today inside di middle of di trade war. Gbajabiamila waka na one of di ways to find solution to di $1million levy wey Ghana sama Nigeria traders for dia kontri.

Last week Nigeria para say dem no go accept how Ghana dey humiliate Nigeria. But Ghana authorities say no be so di mata be.

Tori be say, both kontries never address di mata again for public, since afta Lai Mohammed, Nigeria information minister cut ‘enough is enough’ warning for Ghana and wen im colleague for di Gold Coast Kojo Oppong Nkrumah reply say President Nana Akufo-Addo go discuss wit Nigeria President Muhammadu Buhari to solve di mata peacefully.

But at di moment Nigeria vs Ghana situation don damage?

Recently, Ghana authority close more than two hundred shops wey belong to Nigerians sake of say dem no follow dia trade regulation plus dem neva pay dia 1million dollars levy.

Ghana say dem no want make foreigners enta into retail business as dem reserve dat sector for dia citizens but Nigeria say dat one dey against ecowas protocol.

Genesis of gbas/gbos between Nigeria and Ghana

Since Ghana and Nigeria get dia independence, diplomatic relations between di two kontris always get gbege.

Di two kontris dey always wan prove who beta pass in terms politics, economy, sports, and regional integration.

Even citizens of di two kontris dey drag demselves on top who jallof rice sweet pass- dis wan show di kain rivalry wey don dey between di two kontris.

However, di recent way wey some jaguda pipo demolish Nigrian embassy building for Ghana and di closing of Nigerian retail shops don cause high diplomatic tension between di two kontries.

While di goment of both kontris still dey try find diplomatic solution to di mata, dis na di genesis of how Nigeria and Ghana fight -fight take start.

• Pre-colonial Era: Di first gbas gbos between Nigeria and Ghana start for 1931.

• During dis period, di number of Nigerians wey di live for Ghana reach like 20 percent of di kontri population.

• Many Nigerians dia bin di work as Cocoa farmers, business pipo, labourers and becos Ghana economy bin good, dia business bin dey boom.

• But later during di cocoa hold-up saga for Akyem Abuakwa area, di king and di traditional council bin ask di colonial goment make dem deport Nigerians wey be trouble makers.

Independence Era: Ghana get im independence for 1957 and di head of gonment den be Kwame Nkrumah

At dis time, di population of Nigerians and di business community don grow for Ghana.

Even for dis era, Ghanaian pipo kontinu to mount pressure on top dia goment head to deport Nigerians wey dem refer to as alien.

For August 23 1957, di Convention Peoples’ Party (CPP) government passed the Deportation Act wey give goment right to deport those wey dem consider as threat to dia kontri

During dis period some Nigerians chop deportation and goment describe dem say dem be opposition party members.

Deportation act of 1969: Dis period mark di major deportation of aliens or foreigners dem from Ghana. Close to 200,000 pipo from Togo, Mali, Burkina Faso, and Nigeria bin pack dia kaya waka from di kontri.

Sake of dis deportation, many African kontri begin target Ghanaian pipo dem for dia kontri and begin ask dem make dem leave.

Ghana must go: During di period of 1986, Nigeria presido den, Shehu Shagari ask Ghanaians make dem pack dia load and leave di kontri.

Many of dem bin dey Nigeria to find beta life sef come do dem back, as e ask Ghana pipo to also leave Nigeria.

Wetin di cause bad belle between Ghana and Nigeria?

Di reason Ghana bin deport plenti pipo wey dem refer as alliens from dia kontri na to provide beta job opportunities for dia citizens.

And to also allow dia pipo to get more involved for di kontri economy as foreigners dem bin get business ground for di kontri pass.

Na from since 1931 na im Ghanaians dey try put pressure on dia goment to drive oda nationalities and today, di situation neva change as Ghana business pipo kontinu to ask dia goment to do dey needful

Prof. Bola Akintehinwa wey be former DG of NIIA, say some Some Ghana business pipo dey vex on top how Nigerian traders dey sell dia kaya cheap wit chikili moni

Some times di Nigerian traders dey even cari more quality goods.

Sake of dis, dey business men dey always lobby different goment to put dowm laws wey go favour dem against Nigerians.

Nigeria vs Ghana

Getty Images
President Nana Akufo-Addo

Do me -I- do -you na solution?

Di kasala between Nigerian traders and di Ghana authority fit cause major k-leg for Nigeria/Ghana diplomatic relations.

Since di gbege, mani Nigerians don call on di goment to also fine Ghanaians di same amount and close dia shops to teach Ghana lesson

But oga Bola say why Ghana di try project dia National interest, Nigerian goment no dey do anything.

And dat di best tin to do now na for di Nigerian president, Muhammadu Buhari to try call Ghana president and warn am against wetin e dey do

And tell am say Nigeria also get power to retaliate.

E say do-me -I do you approach no go epp for dis mata and dat both kontris gatz look for diplomatic way to resolve dia wahala.