Cameroon atrocity: Yaoundé court go sentence Zelevet sojas for BBC Africa Eye “2018 Anatomy of a killing” weh Cameroon army find guilty

Contains scenes which some viewers may find disturbing. – Finding the soldiers who killed this woman
The British Broadcasting Corporation

Five sojas weh Cameroon find guilty for “2018 Anatomy of a killing” arrive military court compound on Monday morning 31 August to wait for dia sentence but military court don adjourn sentence for September 21, 2020

De two assessors no bi available, as Barrister Mben Sylvestre explain.

De sentence wey suppose happun on Monday kam one week afta military court pronounce five out of seven soldiers guilty, and free two for 17 August.

Na one year afta court hearing start, to try soldiers weh deh kill woman and pikin dem for Zelevet, Far North Cameroon.

Godwe Mana Didier, Manasse Djakobei Johnathan regain freedom because deh just do follow – follow, di watch as odas bin di kill, Barrister Sylvestre Mben bin tell BBC News Pidgin.

De five guilty soldiers na: Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas, Ntienche Feuroli Ghislain Landry.

Army find guilty

BBC

How tori for Cameroon army killing start

2018:

Viral video weh e komot for social media how soldiers waka wit woman and pikin dem weh deh call for French BH- Boko Haram, reach for some place shoot dem.

July 2018:

But goment first say no bi Cameroon army, say deh killing sef na for Mali.

September 2018:

BBC Africa Eye use high tech for documentary “Anatomy of a killing’ trace de killing.

Inside de documentary, deh show wuasi de kan guns weh soldiers use komot, deh confirm say na uniform weh Cameroon soldiers di use, who de soldiers bi and how deh shoot de woman and pikin dem plenti taims.

De woman and pikin dia crime as deh di tok inside video for French na say deh bi BH-Boko Haram.

De investigate show say soldiers shoot de woman and pikin dem for 2015.

Cameroon atrocity

BBC

August 2019:

Cameroon goment den start trial seven soldiers, Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque Hilaire, Godwe Mana Didier, Manasse Djakobei Johnathan, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas, Ntienche Feuroli Ghislain Landry.

December 2019

Case komot for open court, kontri pipo no bi fit enta hear de case laik before

August 2020

Military court free two of de seven soldiers say deh no get hand for de killing

August 31, 2020, military court go finally sentence soldiers weh deh kill woman and pikin dem show say Cameroon army get stain for how deh di handle crisis.