Chadwick Boseman: Black Panther star wey act King T’Challa die of colon cancer at di age of 43

US actor Chadwick Boseman, wey pipo sabi for im role for Black Panther, don die of cancer, according to im family.

Di 43-year-old die for im home for Los Angeles with im wife and family by im side.

Boseman bin no speak about im illness for public.

But im family say na for 2016 dem diagnose am with stage III colon cancer and im battle with am for di last four years before e progress to stage IV.

“A true fighter, Chadwick endure through it all, and bring you many of di films you don come to love so much,” im family tok inside statement.

Boseman first become popular for playing real-life figures – baseball great Jackie Robinson inside 2013’s 42, and musician James Brown inside 2014’s Get on Up.

However, na di blockbuster Black Panther for 2018 na im pipo go best remember am for.

Boseman act as di ruler of Wakanda, one African nation dem come up with for di film wey get di most advanced technology on earth.

As well as winning praise and taking more dan $1.3 billion US dollars (£973m) for cinemas worldwide, pipo see di film as cultural milestone say e get largely black cast and black director, Ryan Coogler.

Boseman tok last year say di film don change wetin e mean to be “young, gifted and black”.

Black Panther na di first superhero film to get nomination for best picture for di Oscars.

He also play di same role inside oda Marvel films Captain America: Civil War, Avengers: Infinity War and Avengers: Endgame.

Di announcement go come as shock to many as Boseman never discuss im 2016 diagnosis for public.

However, fans start to dey raise concerns over im health dis year due to im noticeable weight loss.

Tributes don start to dey come in for di, including from actor Mark Ruffalo and director Jordan Peele, wey tweet say “Dis na crushing blow”