Helicopter crash in Opebi Lagos: Today aviation accident inside building for Salvation road Ikeja kill at least two pipo – Eyewitness narrate shock ontop wetin happun

Helicopter crash for one residential building inside Opebi, Ikeja Lagos happun on Friday afternoon for Nigeria commercial capital.

Accident investigation Bureau AIB confam di report of di crash of one helicopter for Opebi area of Lagos. And dem don deploy dia crew to di scene, according to AIB tok tok pesinn Tunji Oketunbi.

Lagos State Emergency Management Agency, Lasema tell BBC Pidgin say dem don activate dia resources to di helicopter crash wey happun for 16A Salvation Opebi Road, today, Friday, 28th August, 2020.

Eyewitness wey follow BBC Pidgin tok say dem see di helicopter dey struggle to balance for air before e land ontop di fence wey separate two buildings.

Operations dey ongoing and one pesin survive, two die, Nosa Okubo, Lasema tok tok pesin tell BBC Pidgin.

One eye witness post for tweet say pesin die inside di crash wey happun right in front of im office.

BBC Pidgin find out say di helicopter crash happun around 12:30pm on Friday.

One elderly woman, wey dey live for one of di buildings wia di helicopter crash happun, say she bin dey read her bible for inside di room wen she hear di loud noise of di crash.

“I no fit put myself togeda, I see smoke everywia and di lightning but di light dey on, na im I call my daughter to come check wetin dey happun”, she tok

Helicopter crash in Lagos today

BBC

Na wen I comot to see wetin dey happun I see say na helicopter crash between one house and my daughter-in-law flat.

Di woman say di helicopter crash bin affect two cars for di compound.

Helicopter crash in Lagos

BBC
One of di cars wey detroy fo di crash

Di privately operated helicopter bin dey cari three pipo; two na im di crash kill on impact whilst di third pesin dey for intensive care for di Lagos State University Teaching hospital.

Helicopter crash in Lagos

BBC
Na quorum avaition dem write on top di crashed helicopter.

Director General of di Lagos State Emergency Management Agency say dem be receive distress calls from di helicopter pilot before di aircraft crash earlier today.

Lagos state goment tok tok pesin say dem don cari di deadi bodi of di dead pipo go keep for mortuary.

Lasema rescue workers dey on ground and dem still dey deal wit di incident.

Helicopter crash in Opebi Lagos today

BBC
Dis na di black box from di helicopter crash site.

One man wey say im name na Oladokun, wey dey come di area well-well tell BBC Pidgin say di plumber wey im send to come work for di house tell am say im see di helicopter dey shake for up like e no balance as e dey come down.

He tok say; “E say e be like say di pilot no wan land on any of di building as e dey try fall in between di two buildings make e for no wunjure pipo.”

Helicopter crash in Lagos today

BBC
Oladokun – Helicopter crash in Opebi eyewiness

Im tok say di pilot try to land for open space n aim make am land ontop di fence wey dey between di two buildings.

See fotos from di helicopter crash in Lagos

Helicopter crash in Lagos

BBC
Di helicopter fall ontop residential building for Opebi area
Helicopter crash in Lagos

BBC
Helicopter crash in Lagos

BBC
Helicopter crash in Lagos

BBC
Pipo rush go Salvation road wia di crash happun.

BBC Pidgin waka enta live from di scene wia di helicopter crash happun for Lagos.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/432222267738911

Wia di helicopter crash in Opebi Lagos happun

Opebi na highly residential area for Ikeja di capital of Lagos State even though e get plenty businesses wey open along di major Opebi road.

Opebi na small, serene and somehow quiet environment sake of di category of middle class pipo wey dey live for di area.

Most of di residents and pipo wey get properties for Opebi na former civil servants and retired politicians sake of di closeness to di Lago State Civil service offices.

Di distance between Opebi Link Road to di Murtala Muhammed International Airport na about 9 Km by road.

Helicopter crash in Opebi Lagos today

BBC
Pipo wey dey help di situation for helicopter crash inside Opebi Lagos don move di remains from di aviation accident scene for Salvation road, Ikeja.
Helicopter crash in Opebi Lagos today

BBC

We still dey chook eye inside dis tori, make you refresh dis page for more updates.