Ganduje say e no go waste time to sign di death warrant of Yahaya Sharif-Aminu – See wetin fit happun next

Kano state Govnor, for Nigeria Abdullahi Ganduje don assure say e no go waste time to approve make dem kill di 22 year-old Kano singer Yahaya Shariff-Aminu.

Ganduje wey tok wen e dey address some Islamic scholars for di state say dis na sake of wetin Yahaya Sharif do no dey responsible.

E say di action of di Singer fit cause security gbege for di state and even di kontri at at large.

Dis dey come afta Sharia Court sentence Yahaya to death by hanging for August 10, 2020 say im song wey im circulate for whatsapp for March 2020, dey blaspheme prophet Muhammad SAW.

Even though many Nigerian plus international rights group don condemn di court judgement, govnor Ganduje say di court judgement dey dey pure and correct.

“Wetin di court do dey right and we support am completely”.

“Our eyes di follow di case and we thank Almighty Allah, say di court sitting dey successful,” im tok

Dis na di first time wey oga Ganduje di chook mouth on top di judgement since e happun some weeks ago.

E say im no go waste time to to sign di death warrant wen e dey tok to some Muslim clerics for government house, Kano, adding say im accept di court judgement.

E say di only tin wey fit stop am make e no sign di death warrant na wen di Supreme court give different judgement.

But dat if Supreme court give judgement wey favour and support di sharia court, sharp-sharp im go give approve di verdict.

E add say, if di singer and im family no challenge di judgement wey Sharia court give, im no go waste time to sign di death sentence.

Wetin go happun next?

E dey expected say Shariff go appeal im case for di Sharia court of Appeal within 30 days wen dem sentence am.

If di Sharia court of appeal back di earlier judgement, Shariff still get oppurtunity to go supreme court.

But if within 30 days e no appeal di case, e therefore mean say e don accept di judgement of di Sharia court and if Ganduje approve di execution afta thirty days, dem go kill or execute am.

‘Ganduje dey play politics wit boy life’

Many Nigerians for social media don begin para on top social media sake of govnor Ganduje stand.

While some pipo dey happy say e do di right tin, odas say e wan use di life of innocent boy take play politics.

Dem explain give say plenti pipo wey don commit serious crime no face death and na innocent singer dem one kill.