Macaulay Culkin now: Home alone child actor don grow into American musician and web host – See six correct facts about Macaulay Carson Culkin

Macaulay Culkin

Getty Images
Macaulay Culkins

As ogbonge child actor Macaulay Culkins turn 40 years, everybodi don suddenly dey feel very very old.

Di former child actor enta Twitter break table as im confam to im fans say don turn big 40, and im want make im fans feel old.

But, wetin and weitn you sabi about di actor wey totori our childhood wit in popular feem Home Alone?

Which oda feems im act?

No be only Home Alone and Home Alone2 most of im fans take sabi Macaulay Culkins aka Kevin McCallister wey fit stay home alone wen all im family members travel for Christmas.

Di popular child actor for di 1990s, also act for feems like My Girl, The Good Son, The Nutcracker Uncle Buck and Richie Rich.

During di period wey im reign, Culkins sabi pipo for entertainment industry regard am as d most successful child actor since Shirley Temple for di 1930s.

Im take break from acting for 1994 before im return again for 2003.

Macaulay Culkins

Getty Images
Macaulay Culkins wen im be small pikin

Wetin Culkins dey do now?

Oga Culkins begin im career wen im be 10 years old small pikin for di 90s, but since den reach now im don enta aspects of di entertainment industry.

Today, im na musician, actor and web host.

Im co-found di comedy rock band Pizza Underground for 2013 but di band split for 2016.

Now im na publisher and CEO of one satire pop culture website and podcast wey dem dey call Bunny Ears.

Culkins cari im papa and mama go court

Wen Macaulay Culkins reach 16 years, im cari im mama and papa go court make dem remove hand from im moni.

Im remove a whole $13 million of im moni wey dey im parents account put am under di control of di family accountant until im turn 18.

Marraige

Culkins bin marry actress Rachel Miner for 1998 wey di two bin de 18 years.

Dem separate for 2000 den finally divorce for 2002.

Macaulay Culkin

Getty Images
Macaulay Culkins dey sing for statge wit shekere

Awards

Afta im act for Home Alone2: Lost in New York for 1992, im get nomination for dt Golden Globe Award for Best Actor- Motion Picture Musical or Comedy.

For im get nomination for di MTV Movie Awards and Young Artist Awards.

Im rank number 3 for di VH1 list of “100 Greatest Kid-Stars” and E! list of “50 Greatest Child Stars.”

Culkins chill for prison

Police arrest am for 2004 say im cari marijuana plus two oda hard drugs.

Im chill small for prison before dem release am on bail wit $4,000.

Im first tell court say im no dey guilty but later change am to guilty.

Court sama am three one year suspended sentence plus order am to pay $540.