Paul Pogba catch coronavirus na di latest from Manchester United camp.
Tori be say di midfielder Paul Pogba don test positive for coronavirus according to France manager Didier Deschamps.
Di 27-years-old go now go stay for separate room alias self-isolation for 14 days.
Paul Pogba go miss France Nations League game against Sweden on Saturday, 5 September and di match against Croatia three days later.
- Wetin dey inside Messi contract, release clause from Barcelona? – Dis na wetin we know
- How dis Man Utd defender run afta tiff wey dey escape ontop bike, catch am & hand am over to police
- Players wey cough go get red card from now for English Football
Dis tori of Pogba coronavirus status dey come only weeks before di Premier League new season go start on September 12.
However, di midfielder fit still dey ready alias eligible for selection for United first game of di season against Crystal Palace for Old Trafford on 19 September.
Im club Manchester United say: “Everybodi for United wish Paul speedy recovery ahead of di new season.”