BBNaija eviction: How housemates vote Praise comot Big brother Naija 2020 season 5 lockdown house

Nelson Praise don comot di Big Brother House. We fit tell you say na six of im fellow housemate vote am out.

Earlier, out of 15 housemates, Trickytee, Wathoni, Praise and Vee bin dey di four housemates wit di lowest votes from fans of di reality show dis week.

How housemates vote who go comot big brother house

  • Tolanibaj vote to evict Praise and Vee
  • Ozo vote to evict Praise and Trikytee
  • Lucy vote to evict Trikytee and Wathoni
  • Erica vote to evict Vee and Wathoni
  • Prince vote to evict Wathoni and Vee
  • Laycon vote to evict Trikytee and Wathoni
  • Dorathy vote to evict Trikytee and Vee
  • Neo vote to evict Praise and Wathoni
  • Nengi vote to evict Praise and Wathoni
  • Brighto vote to evict TrikyTee and Praise
  • Kiddwaya vote to evict Praise and Vee

E end up say Wathoni and Praise bin tie for who go comot with six votes each but biggie give di Head of House Kiddwaya anoda vote for who go comot di house wey im give Praise.

Now, Praise don join oda housemate – Ka3na, Lilo, Eric, Tochi and Kaisha wey don comot from di house.

On Monday, Big Brother go release informate ontop how oda housemates bin vote.

How di Live Eviction dey work dis season?

Di housemates wey enta di house for July 19 don spend 35 days days out of dia 71 day journey so far.

So far, na at least one out of di housemates wey dey up for possible eviction dey leave di show on Sunday and na di oda housemates dey decide who dat pesin be.

Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.

Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.

Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.

How di Head of house and deputy escape eviction?

Kiddwaya win di Head of House challenge on Monday and wit dat victory e get automatic immunity from possible eviction.

Im choose Tolanibaj as im deputy she sef get immunity sake of di title.