Cameroon army killings: Two sojas inside viral video wey e show how deh di kill woman and pikin dem regain freedom?

Kontri pipo di wanda why two of de seven soldiers weh deh kill woman and pikin dem for Far North Cameroon fit regain freedom.

Tori na say viral video bin komot for 2018 as uniform men di shoot, woman and pikin dem for Zelevet, for Far North Cameroon deh deh bi Boko Haram.

Den, goment bin first deny say no bi Cameroon soldiers, BBC Africa Eye use technology identify de year weh deh kill, 2015, de soldiers, confirm say na for Cameroon.

Afta dia arrest, military court bi try seven soldiers: Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque Hilaire, Godwe Mana Didier, Manasse Djakobei Johnathan, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas, Ntienche Feuroli Ghislain Landry weh deh kill woman and pikin dem for viral video for 2018.

Court bi decide say de hearing no go bi for open court, and since den kontri pipo no di get idea weti di happen.

Soldiers in Burning Cameroon video

AFP
Security forces are battling to contain the conflict. Soldiers of the 21st Motorized Infantry Brigade patrol in the streets of Buea, South-West Region of Cameroon on April 26, 2018.

For August 17, two of de seven soldiers, Godwe Mana Didier, Manasse Djakobei Johnathan regain freedom because deh just do follow -follow, di watch as odas bin di kill, Maitre Sylvestre Mben tell BBC News Pidgin.

De ring leader, Fabassou no bi call dem for yi assassination operation, de lawyer add.

Five soldiers bi guilty, Fabassou Etienne, Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas, Ntienche Feuroli Ghislain Landry.

Fabassou bi guilty as pesin weh e organise de killng. Bitouala Ciriaque, Tchanga Chiengang Jean B, Donassou Gorvo Barnabas bi guilty as deh shoot and kill woman and pikin dem.

Ntienche Feuroli Ghislain Landry bi guilty say e violate instructions because na e bi di film de odas.

Amnesty International bi don warn Cameroon authorities say make de soldiers weh deh take part for de killing no escape punishment.

For August 30 de world go know de kana punishment military court go give soldiers weh deh kill woman and pikin dem for Far North Cameroon.