Nigeria army recruitment 2020: How to apply for DSSC, SSC ontop di employment portal of di force

Di Nigerian Army don officially open dia 2020 registration exercise web portal for pipo wey wan apply for Direct Short Service Commission and for Short Service Combatant commission.

Di Headquarter of di Nigerian Army wey announce am for dia twitter handle say di recruitment na online and registration go start immediately.

Di Nigerian Army add say di 2020 SSC Course dey open to to everybody wey be Nigerian by birth e no mata if di pesin na civilian military personnel wey still dey serve.

How to apply

  • If you be interested and qualified candidate, waka go apply online for recruitment.army.mil.ng or visit Nigerian army web page at recruitment and choose SSC or DSSC option from the page.
  • From dia, choose di course you dey qualify for
  • Apply for am and di application dey free of charge
  • Form dey to fill wia applicants go need upload documents like Passport Photograph, Educational certificates, Evidence of membership any professional body, Certificate of State of Origin, Birth certificate or age declaration .
  • Applicants must print out dia online generated photo-slip afta dem complete di application. Na di Registrar of any Court of Law go sign di first page while di applicants Local Government Chairman/Secretary or any military officer of the rank of Lieutenant Colonel or equivalent and above wey come from di applicant state of origin go sign di second page
  • All applications must dey submitted not later than 29 September 2020.

Qualifications

  • Applicants need to be Nigerian citizen by birth.
  • Height must pass 1.68m for male and 1.65m for female
  • Applicants must dey medically and physically fit
  • Applicants must not get criminal conviction(s) from court of law in dia history
  • Applicants age must dey between 23 and 27 by January 2021
  • Applicant must get valid birth certificate wey di National Population Commission endorse, Hospital or Local Government Council or valid age declaration
  • Applicants must get at least first degree and no get less than Second Class Lower Division or HND wey no less than Lower Credit for arts, sciences or humanities from accredited institution of learning
  • Candidates must submit Letter of Attestation from dia former institutions
  • Candidates must not draw tattoo or write any thing for body
  • Candidates must don finish NYSC, get NYSC discharge certificate or a valid certificate of exemption dos wey just serve finish fit apply
  • Candidates must not be members of any cult/secret society/fraternity.