BBNaija: Kiddwaya, Tolanibaj na new head of house and deputy for Big Brother lockdown season 5

Terseer Waya, aka Kiddwaya don become di new head of house of Big Brother season 5 afta im win di HoH Challenge dis evening.

As Head of House, Kiddwaya don get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week.

Im also get di power to pick any housemates as in deputy to follow am jolly immunity and di lounge,

E don nominate Tolanibaj as im deputy for di house. she go follow enjoy access for Head of House lounge and inmmunity for eviction..

Im go be di second male housemate wey go be HoH afta Ozo wey rule di house week before last.

Dis one go make am two weeks back-to-back im don get immunity for di house as e be deputy HoH last week under Erica.

Big Brother add more jolly for di mata as im announce say both Head of House and im deputy go fit select one housemate each wey go follow dem jollificate for di Head of House Lounge, only thing be say dis two housemates no go fit sleep for dia.

As e be now, na 13 housemates dey on di line for possible eviction.