Waec mathematics expo: See West African Examination Council reaction to di 2020 maths waec expo in Nigeria

waec mathematics expo

BBC
Ova 1.5 million final year secondary school students for Nigeria dey start dia Waec exams on Monday.

West African Examination Council don warn students say di mathematics paper wey dem dey see for social media and oda platforms na fake.

Waec for Nigeria tell BBC Pidgin say na scammers dey sample all those fake exam papers and dem plan to use an collect money from dia victims.

Ova 1.5 million final year secondary school students for Nigeria dey start dia West African certificate exams WAEC on Monday.

Waec mathematics expo

BBC

“Any student wey collect di fake exam papers go surprise wen dem enta exam hall as e go dey different from wetin dey ground”.

WAEC tok tok pesin for Nigeria Demianus Ojijeogu tok say WAEC never write mathematics exam for Ghana as some pipo dey tok.

Dis na sake of rumour wey to say na di same mathematics paper wey dem write for Ghana na im dem wan write for Nigeria.

Waec mathematics expo

BBC
Ova 1.5 million final year secondary school students for Nigeria dey start dia West African certificate exams WAEC on Monday.

“I see three of those papers yesterday, all of dem na fake” Na so Mr. Ojijeogu tok.

Na on Monday 17 August, 2020 na im di candidates go write di general mathematics paper across all exams centres.

Waec mathematics expo

BBC

Nigerian students bin resume early dis months afta about five months wey dem siddon for house sake of coronavirus lockdown order.

Waec advise candidates to obey di rules and regulations wey dey guide di conduct of di examination by removing hand from all kind of malpractice and obeying all Covid-19 protocols wey di examination centre don put in place.

See di timetable WAEC release for Nigerian candidates: