More than 1.5 million student dey write dia WAEC exams across di 36 state of Nigeria afta months of coronavirus lockdown.
Di exam start 9:30 local time. Di exam di happun for nearly 19,000 schools.
- Waec mathematics expo leak? See wetin really happun
- See di approved WAEC 2020 past questions wey go help students pass
BBC Pidgin visit some schools across Nigeria to see how dem dey comply wit goment coronavirus safety rules to protect students from di infection.
Nigerian students bin resume early dis months afta about five months wey dem siddon for house sake of coronavirus lockdown order.
Waec advise candidates to obey di rules and regulations wey dey guide di conduct of di examination by removing hand from all kind of malpractice and obeying all Covid-19 protocols wey di examination centre don put in place.
- Ooni suggestion to replace BBNaija show no go down well
- Meet di housemates of Big Brother Naija lockdown Season 5
- Burial coffin of dis ‘Nigerian rich man’ dey make many wida – More fotos & gist dey here
- Wetin we know about dis beautiful Nigerian lady wey truck crush to death weeks to her wedding