Unilag VC Ogundipe: University of Lagos campus protest, Wale Bablakin appointment of Prof. Soyombo wey lawyer Mike Ozekhome dey challenge for court and how evritin take start

University of Lagos

BBC

Di Governing Council of University of Lagos wey di Pro chancellor and Chairmo of Council, Babawale Babalakin dey lead bin comot Professor Oluwatoyin Ogundipe as Vice Chancellor of di university on Wednesday, 12 August.

E bin happen afta one Governing Council meeting for di headquarters of di National Universities Commission for Abuja wia dem state say di reason for im removal na “serious acts of wrongdoing, financial anyhowness, gross misconduct and abuse of office”.

But Professor Ogundipe no gree – shortly afta reports begin spread say dem don sack am, im reject im removal as di Vice Chancellor of di University say e dey against di University of Lagos Act.

Ogundipe bin tell di public make dem no mind di “ye ye informate”, say “Professor Ogundipe na still di Vice Chancellor of di University of Lagos”, im tok inside statement.

Dis one no move di University of Lagos (UNILAG) Governing Council as dem do strong head, announce Prof. Theophilus Soyombo as di Acting Vice Chancellor to replace Prof. Oluwatoyin Ogundipe.

Di Dean of Student Affairs, Professor Ademola Adeleke tell BBC Pidgin say dis mata no go affect students because as e be so, di university no dey open and di Academic Staff Union of Universities (ASUU) still dey on strike.

Wetin be di legal way to comot Vice Chancellor for di university

Dem bin sack di Vice Chancellor afta di Governing Council of UNILAG do meeting. Local reports be say even members of di council bin vote di Vice Chancellor out while four bin vote for am to dey on suspension instead.

Professor Ogundipe don argue say di process wey dem use comot am for office dey illegal.

So wetin be di lawful way to comot sitting Vice Chancellor for di University of Lagos?

According to Section 17 of di University of Lagos Act (dat na di law wey establish di university), “if e appear to di Council say member of di Council suppose dey removed from office on grounds of misconduct or say e no fit perform di function of im office, di Council go make recommendation through di Chancellor, to di Visitor, and if di Visitor don make enquiries finish, go approve di recommendation, inside writing wey im sign, comot di pesin wey dey in question from office”.

President Muhammadu Buhari na im be di visitor of University of Lagos and e never comment on di mata so far.

As tins be so, Federal Goment through di Ministry of Education don wash dia hand comot from di sacking of di Vice Chancellor, say nobody don brief dem.

Professor Ogundipe don cari di mata go court wia Senior Advocate of Nigeria, Mike Ozekhome go dey argue im case.