International Youth Day quotes: 2020 ‘World Youth Day’ message from Sowore, Atiku, Okowa, Muhammad-Bande, Uzodinma to Nigeria young pipo

Di first of World Youth Day’ happun on 12 August, 2000 and since den, dat date be wen di world celebrate dia young pipo.

International Youth Day (IYD) na di day set aside for awareness by di United Nations to draw attention to cultural and legal issues wey youth dey face for di world.

Nigerian governors and oda ogbonge leaders for Nigeria don join mouth to wish di youth of di kontri good-good tins.

See quotes from Nigerian leaders on 2020 International Youth Day

President of di 74th session UN General Assembly, Tijjani Muhammad-Bande, use di day give gbosa to all di youth for di tins wey dem dey do for di world.

”Young pipo be trail-blazers of progress. As entrepreneurs, activists and community leaders, you no dey only inspire change – you dey create it”

Im also encourage young pipo for di world to participate for upcoming online #UN75 Youth Plenary, wey go happun on 9 September 2020, and add dia voice to shaping di United Nations for anoda decades.

Also, Atiku Abubakar, wey bi former Vice President for Nigeria, salute youth for Nigeria on dia commitment even as di world fight coronavirus.

He say: “Di power and spirit wey you carry as youth go play crucial role for di socio-economic survival of di world, and how e go rejuvenation afta post-COVID19.”

Ifeanyi Okowa, Govnor of Delta State, South-south Nigeria, release video to celebrate youth for im state.

He say “we work to empower our young pipo for di future wey lie ahead. Today, we join di world to celebrate dia power, dia promise, and dia extraordinary potential”.

Govnor of Ekiti state, southwest Niegria, Kayode fayemi. Also give kudus to young pipo for wetin dem dey do.

“Happy International Youth Day to di sabi minds wey go define di future; di teachers, innovators and creators of greater Ekiti,” he tok.

Also, Govnor of Imo State, south-south Nigeria, Hope Uzodinma, say di youth na di future of tomorrow and encourage make goment invest for youth matter.

“Na di leaders of today, wey must lay di solid foundation for di leaders of tomorrow. If leaders of today we fail to provide di youths with quality education and sound socio-economic playing field to realise dia God given talents, den we cannot blame dem if dey turn out to become unproductive and irresponsible,” he add.

Adegboyega Oyetola, Govnor of Osun state, southwest Nigeria, say im do meeting to with young of di kontri to tok about program and plans wey go beta di lives of young pipo for dia state.

“We believe say engaging di youth for positive development go ensure safer and better Osun,” na wetin im tok.

Anoda ogbonge Nigerian wey celebrate youth na di 2019 presidential candidate for di kontri, Omoyele Sowore.

Di activist Nigerian youths no fit reasonably celebrate youth day today, until time wey “our young pipo dey free and fit attain dia full potential”.

For di south west State of Ogun, Govnor Dapo Abiodun tok say im dey committted to di development of young pipo.

Di theme for 2020 IYD na “Youth Engagement for Global Action”.

And as di world dey mark International Youth Day, World health Organisation don call on youth around di world to lead, take action and fight Covid 19 pandemic for a better future.

WHO add say young pipo no dey invincible or immune to di virus.