Unilag: Professor Oluwatoyin Ogundipe say im still remain University of Lagos Vice Chancellor

University of Lagos (Unilag) don deny report wey dey spread say dem don remove di school vice chancellor, Prof. Oluwatoyin Ogundipe.

Some local media bin carry report say di university governing council remove Oluwatoyin Ogundipe as di vice-chancellor of di school.

But for one statement wey Professor Oluwatoyin T. Ogundipe sign dem deny di rumour and say na anyhow imagination of di pesin, Oladejo Azeez wey dey spread am.

“Notice to di General Public on di Removal of di Vice Chancellor, University of Lagos by Oladejo Azeez, Esq” di statement tok

  • See WAEC timetable for di 2020 examination wey go begin August 17“Di attention of di University of Lagos (Unilag) management don dey drawn to di; ‘Notice to di General Public on di Removal of di Vice Chancellor, University of Lagos’; dated August 12, 2020 and signed by Oladejo Azeez, Esq, Registrar and Secretary to Council, stating say dem don remove di current Vice Chancellor, Professor Oluwatoyin T. Ogundipe, FAS from office with immediate effect.” “Dis no be true and na figment of im imagination. Therefore, we dey advise stakeholders of Unilag and di general public to disregard dis mischievous disinformation about di sitting Vice Chancellor of Unilag, contained for dat notice. “

“Professor Ogundipe still remains Unilag Vice Chancellor. ”