Lyta new record label: Naira Marley sign Opeyemi Babatunde Rahimto MarlianMusic months afta disagreement wit Olamide YBNL Nation

Lyta, wey be young Nigerian singer on Wednesday reveal say im go soon drop im next single.

Di announcement wey Lyta drop form im Instagram page land just one day afta Popular Nigerian singer, Naira Marley sign di 22 year old singer to im record label.

On Tuesday, Marley post for im Twitter page to share one picture of Lyta wit document wey appear to be a record deal, wit di caption: “Welcome to MarlianMusic Lyta.”

Lyta say im dey so excited to join wetin im call im new family Marlian music and also thank Naira Marley.

https://www.instagram.com/p/CDwsJerstg7/

Naira Marley bin launch im own label for January, 2020 MarlianMusic wen e sign four artistes—Zinoleesky, Mohbad, Cblack, and Fabian — during one ogbonge concert alias ‘Marlian Fest’ inside Victoria Island, Lagos.

Lyta music journey before e join Naira Marley marlian music

Dis dey happun just one year afta e bin join Doro Music and release im popular single, ‘Monalisa,’

Tori be say Lyta wey real name na Opeyemi Babatunde Rahim, na singer and songwriter.

https://www.instagram.com/p/CDybt6Esk3Q/

Di Nigerian singer sign a record deal wit YBNL Nation in 2018 but e leave di label in May 2019 afta e bin get disagreement wit Olamide.

Di association no end on di best of terms as Lyta accuse legendary artist, Olamide of some questionable things. Olamide respond to Lyta inside one open letter.

Lyta release im 5-track debut EP Id in 2019 and 4 July 1998 dem bon di 22 year year old Ajegunle based singer