JAMB post UTME: University and higher school go start admission screening by September

JAMB post UTME

Getty Images
Students sidon for University of Lagos

Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) for Nigeria don order say 2020/2021 post-Unified Tertiary Matriculation Examination screening must start September 7.

Jamb tok tok person wey follow BBC Pidgin tok say di new date na to make sure say everybody get chance to do dia Post-UTME including student wey register with awaiting result.

Joint Admission and Matriculation Board reach di agreement on Monday afta dem do meeting with Vice-Chancellors, Rectors, and Provosts of tertiary institutions.

Before, di board bin don issue guideline for all tertiary institutions to start dia admission with effect from August 22.

“We come out with resolution after di meeting say no post-UTME exercise must happun before September 7 to October 4.

“Also for pipo wey go write dia post-UTME on September 7 to October 4, we go need do anoda one for November 18 sake of candidate wey go do NABTEB.

“di reason for dia date na say at di end of di day, all di results go don comot and everybody go don get opportunity to compete.

“For schools wey no go do any screening exercise, wey be say na only JAMB dem go use, dem fit start to dey make recommendation and to choose dia candidates but dat process no go end until sometimes in November or end of November wen goment go announce close of admission.