Diezani Alison-Madueke yahoo-yahoo video: Nigerians react as di ex-minister of petroleum resources condemn internet fraud

Former Nigeria Minister of Petroleum Resources Diezani Alison-Madueke dey trend on top twitter.

Dis one na afta one video wey go viral show her dey condemn yahoo-yahoo pipo for di kontri dey look up to dem.

Some react say di former minister wey get corruption case to ansa no get mouth to tok.

Wetin she tok

For one event wey di Ijaw National Development Group bin organize, di formal petroleum minister say reason why pipo no dey follow culture, traditions and do right things again for di kontri na because many young pipo role models na yahoo boys.

She say dis internet fraudsters dey bring bad societal behaviours and values and dis dey bad for di kontri image.

Di publisher of Point Black News Jackson Ude post di video for twitter.

Her former boss and di former President of Nigeria Goodluck Jonathan also attend di programme online.

‘Take di message, leave di messenger’

Some President Muhammadu Buhari aides don chook mouth for di mata.

Di Personal Assistant on New Media to President Muhammadu Buhari, Bashir Ahmad advice say make pipo take di message and free di messenger.

Also, di Special Assistant to President to President Muhammadu Buhari on Digital and New Media Tolu say Madam Dizeani don become motivational speakers for yahoo boys.

Cases wey Diezani dey ansa

Madam Diezani dey UK since 2015, she dey under investigation for money laundering dia, while EFCC don name her for different corruption trials.

Dis mata first start for 2014, wen di Nigeria Central Bank Governor for dat time, Sanusi Lamido hala say $20bn of oil money dey miss wen Madam Diezani be oil minister, but she deny am dat time.

Since den, EFCC don secure court order to seize some of madam Diezani property plus including her Jewellery wey reach $40m and convict odas wey benefit from di $115m slush fund.

Madam Alison-Madueke dey face mata of money laundering and acquisition of properties wey dey against her for UK court.

For October 2015, di UK National Crime Agency arrest her as part of dia investigation on top bribery and money laundering case.

Authorities for America don also dey put eye for her bodi on top different multi-billion dollar fraud and money laundering offences wey dem dey accuse her for.