Buruji Kashamu dead: Senator Ben Murray-Bruce, Olusegun Obasanjo, Dapo Abiodun, Ayo Fayose, Amosun mourn Kashamu death, Nigeria Senate ex-member wey die of Coronavirus for First Cardiology Consultants

Senator Buruji Kashamu wey be popular political figure for south west Nigeria don die.

Buruji Kashamu die on Saturday 8 August, 2020 for First Cardiology Consultants hospital inside Lagos.

62 year old Kashamu die of coronavirus (Covid-19), according to im friend Senator Ben Murray-Bruce im former colleague for di 8th Nigerian Senate wey announce im death.

Senator Buruji Kashamu burial go take place on Sunday 9 August, 2020 for im hometown of Ijebu Igbo, Ogun State.

Dem go bury late Kashamu according to Islamic rites by 12 pm, im tok tok pesin Austin Oniyokor add.

Until im death, Kashamu na Nigerian politician wey serve as a Senator representing Ogun East inside di 8th National Assembly.

Friends and colleagues react to Buruji Kashamu death

Former President Olusegun Obasanjo wey from di same Ogun Sate wit di late Senator tok for letter of sorry message wey don go viral for social media say Buruji Kashamu try avoid justice, but im no fit escape death.

Many of im padipadi dem, mainly Nigerian politicians, Govnors past and present, as well as supporters don waka enta social media to react afta di news of Buruji Kashamu death:

Senator Ben Murray-Bruce, Ademola Adeleke, Govnor Dapo Abiodun, former Govnor Ibikunle Amosun and Ayo Fayose na some of di many Nigerian politicians wey dey mourn Burji Kashamu death, di Nigeria Senate former member.

Who be Buruji Kashamu

Buruji Kashamu dey married and e get pikin before im death. Na Senator Kashamu be di founder of Western Lotto Limited, wey be one of Nigeria lottery operators.

Senator Kashamu bin also serve as Vice-Chairman of di Senate Committee on States and Local Government wen im bin dey senate.

Oga Kashamu be di 2019 Ogun State govnorship election candidate of di Peoples Democratic Party before im lose to Dapo Abiodun of di All Progressives Congress.

Im be di chairman of di Nigeria opposition party People’s Democratic Party, PDP for Ogun State. Dem appoint am as di chairman, Organization and Mobilization Committee of di PDP for di South West zone of Nigeria.

For 2018, dem suspend oga Buruji Kashamu from di People’s Democratic Party, one Abuja High Court later cancel di decision for October 2018.

Dem born Oga Kashamu for Ogun State, Nigeria on 19 May 1958.

Kashamu start im education for Ansarudeen Primary School, Ijebu Igbo before im comot for 1972 to complete im primary school education for St. John Modern School, Lagos.

Im dey survived by im wife, Susan Buruji Kashamu and daughter Sherifat Kashamu.

For years before Senator Buruji Kashamu death, im be wanted man for United States on top accuse of pushing drug offenses. But im always deny wrongdoing.