Bauchi woman Balaraba Ibrahim na Nigeria first ‘Special Assistant on Divorcees’ not ‘Unmarried Women’

BBC

As discussions dey continue over di appointment wey Bauchi govnor for northern Nigeria give Balaraba Ibrahim as special assistant, di goment don come out to clarify say na Special Assistant on Divorcees dem appoint Balaraba.

Di State govnor Bala Mohammed na im according to im tok tok pesin give Balaraba di position as goment wan helep divorcees for di state

Who be Balaraba Ibrahim SA on divorcees?

Before now Balaraba Ibrahim na chairlady for di association of divorced women for Bauchi state and she dey organise meetings and programs for divorcees for di state.

Pesin wey know her wella wey speak to BBC say Balaraba herself a divorcee with children dey live to helep divorcees and also dey help arrange re-marrying for some wey wan remarry or do business.

Before her appointment she also be staff for Federal Government College Azare.

Balaraba Ibrahim of Bauchi

BBC

Bauchi goment say na SA on divorcees dem appoint her

Mukhtar Gidado wey be tok tok pesin to Bauchi state govnor Bala Mohammed for northern Nigeria tell BBC say discussions especially on social media regarding special assitant appointment on unmarried women no dey correct as na on divorcees e suppose be.

Mukhtar add say di error on appointment letter of di appointee Balaraba Ibrahim wey read special assistant on Unmarried women instead of Divorcees na from Secretary to the State Government office.

“Di appointment wey govnor give her (Balaraba Ibrahim) na special assistant on divorcees but di appointment letter get error wey show say na SA on unmarried women wey no correct.”

“Already dis woman na she be Chair lady of divorcees for Bauchi state and dem get programs wey she dey do to helep divorces dis na why govnor appoint her to dis position.”

Di tok tok pesin say Bauchi goment copy di appointment from Kano state wia dem get pesin wey dey co-ordinate affairs of divorcees especially as e be say dia goment fit wan arrange marriage for dem.

“Na from Kano we copy dis position and e go helep goment when we don do anything to helep divorcees or arrange goment sponsored marriage for dem.”

Di Oda unusual positions for Nigeria

Special adviser to Kano govnor on graveyard matters- Dis na position wey Kano govnor dey give somebody to dey handle issues wey concern graveyards for di northern state

Special assistant on streetlights- Dis one also for Kano state wey last year di govnor appoint pesin to dey take care of di streetlights issues for di state

Ministry of happiness- For 2017 Imo state for eastern part of Nigeria under former govnor Rochas Okorocha create dis ministry to dey guide oda ministries and agencies to ensure happiness of di pipo.