BBNaija: Erica and Kidd ‘ship’ for Big Brother Naija show dey make fans heart cut – See di reason why

Fans of Big Brother Naija dey react to Kiddwaya and Erica relationship afta she tell am say make dem continue as friends and nothing more inside di house.

On Wednesday August 5, afta dia Wager rehearsals, Erica and Kiddwaya do two aside tok wia she tell am say she wan to focus on di game without any man distraction.

She say she dey enjoy all dia cuddles and intimate moments wey dem dey share togeda but going forward she go like focus on her game and career.

Afta she tok finish, Kiddwaya no fight or tok too much e just say ok and carry on with im normal activity for di house.

Dis na di end of Kiddrica?

E no reach complete 24 hours afta two of dem discuss about dia relationship mata say make dem just be friends, dem begin play love again.

Kiddwaya and Erica hold each oda for chair for parlour, eat from di same plate and even kiss too join.

Many fans enta social media to react to di couple relationship mata for inside di Big Brother Naija lockdown house.

Dem use di #kiddrica to express how dia relationship dey go so far.

Dis week, 16 housemates dey up for possible eviction on Sunday, na only di head of house Ozo and Deputy head of house Dorathy dey safe from eviction.

Voting go end on Thursday August 6.