Naira Marley: Police arraign Nigerian singer Azeez Fashola for breaking Lagos Covid-19 rules

Police for Lagos don carry musician Naira Marley go court ontop accuse say e break Covid-19 rules.

Naira Marley appear for Lagos State Special Offences (Mobile) Court, Oshodi say e violate di rule of movement and interstates travel order for Lagos.

According to statement from di Lagos state police command spokesperson Bala Elkana, operatives of Lagos State Police Command, from di State Criminal Investigation Department, Yaba arraign di Nigerian singer and songwriter Azeez Adeshina Fashola, wey pipo sabi as Naira Marley, for di Lagos State Special Offences (Mobile) Court, Oshodi on Thursday, 6, August, 2020 around 3:30pm, say e violate di restriction of movement and interstates travel order wey dey Lagos.

” It would be recalled that on 13/06/2020 around 1400hrs, di suspect in total violation of di lockdown order, embark on non essential travel from Lagos to Abuja and back to Lagos di same date, through di Murtala Muhammed International Airport, Ikeja for one musical concert for di Federal Capital Territory, Abuja.” Di statement tok.

Di police spokesperson say dem arraign Marley along with im Manager Seyi Awouga ‘f’ on one count charge of breach of cessation of movement and interstates travel order by di President of di Federal Republic of Nigeria under Regulation 4(i) of di Lagos State Infectious Disease Emergency Prevention) Regulation No 2 of 2020.

Police also say dem commit offence wey dey punishable under Section 58 Public Health Law, Ch. P16, Laws of Lagos State 2015.

Di two accused persons plead guilty to di charge and di presiding Magistrate award dem fine of one hundred thousand naira each.

Marley concert for Abuja for June cause kasala say e break coronavirus rules as more dan 20 pipo bin gada and dem no keep social distance rule.

For April dis year, Naira Marley still enta palava say im break Covid-19 lockdown rules wen im party for actress Funke Akindele house.

But di Attorney General and Commissioner for Justice, Moyo Onigbanjo SAN, file motion to withdraw di case against im and two odas wey bin attend di party.

Di court sentence Funke Akindele and her husband, AbdulRasheed Bello to 14 days community service, 14 days isolation plus fine of 100,000 naira.