Ozo and Prince BBNaija: Why Big Brother Naija Head of House tell Prince ‘shut up’ as dem dey do drama rehearsal

Ozo and Prince kwanta for Big Brother Naija house sake of to win dis week Wager Challenge.

Di Housemates bin stay awake for night to practise dia music drama. Wit Trikytee as di producer and leader of dis task, di housemates gats wear dia acting masks wit some level of discipline and seriousness.

As dem dey do rehearsal for dia music drama, Prince waka comot from di rest of di Housemates and Ozo no take am funny. For di first time, Ozo begin rake no be small.

As Ozo dey shout. Prince just dey calm, so di quarrel no turn fight. Trikytee bin also step in to control di matter.

E no reach one minute, Ozo calm down come tok sorry to di House unto say im lose im temper. Im also tell Prince sorry say im shout on am, while im dey explain to Prince say e dey disrespectful to di House as im walk out.

Tho di quarrel no last for long, e shock pipo to see Ozo for dat kain mood.

Now pipo don begin wonder weda di shouting na because Prince bin waka comot from di Housemates or weda Ozo dey vex say Prince dey close to Nengi – di babe wey im dey eye for di House.