Lebanon explosion: Beirut blast throw me up, I see plenti dead body for ground – Nigerian survivor

One Nigeria lady wey survive di huge explosion wey happun for Lebanon capital, Beirut say she dey lucky to dey alive afta di explosion throw her up and collapse part of di five story building wey she dey.

Nkiru Obasi wey come from Ebony state, South East Nigeria but dey stranded for Lebanon say di whole tin happun like film.

“For around 4: 00PM we begin see say smoke dey come out from one ship inside water. My oga wey I dey work with call me and show me di fire. I come dey surprise how fire go dey come out from ship inside water.

“My oga brother bin dey use phone dey vdeo everthing and I later go back to my room.”

Beirut explosion video: Di moment big blast hit Lebanon capital
The British Broadcasting Corporation

“Before we know wetin dey happun, di fire come plenti, ground begin shake and di house begin shake, all of a sudden everytin just turn upside, di explosion throw me up. Then my oga brother wey dey bin record wetin dey hit im head for wall while di man wey I dey take care of hit im head too.”

Na so glass wey di explosion scata fall for my body, di building wey I dey don dey collapse, na so I manage escape and as I dey come out, I begin dey see dead bodies for road.”

Nkiru wey just recently get job to look afta old pesin close to di place wey di explosion happun, say blood just dey flow from her body.

“Na pharmacy I go get drugs and one of my girl friend na im come dey help me comot di glass wey shattered all ova my body.”

Lebanon domestic workers: Regina narrate her experience
The British Broadcasting Corporation

Nkiru say she later go hospital dis morning because dem tell her say na free but before dem even attend to her, she almost faint because she don loss a lot of blood.

“After I don spend more than two hours na im dem come attend to me.” Nkiru tok.

For one video wey Nkiru share for social media she say she need help and di experience don affect her movement.

“Right now, I need help I no fit waka proper right now. I wan go back to Nigeria. I go dey happy if Nigeria goment or any Nigerian come to my help.”

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/723563828497665/

Wetin cause di Beirut explosion

Lebanon President, Michel Aoun say na 2,750 tonnes of ammonium nitrate wey dem be store unsafely inside one warehouse for six years cause di Lebanon explosion in Beirut.

Di explosion wey happun on Tuesday kill up to 100 pipo and injure more than 4,000 odas.

Currently, rescue workers dey search rubble for di port of Beirut wia di explosion happun.

Lebanese Red Cross tok say dem dey worried say di number of casualty fit rise pass 100 deaths as many pipo still dey miss from di blast wey happun around 15:00 GMT.