Dubai fire outbreak: Ajman market dey burn inside huge firebreak for Dubai Metropolitan Area of United Arab Emirates (UAE)

Massive fire break out inside Ajman market area of United Arab Emirates (UAE) on Wednesday evening.

Many fire fighting engines na im dey rush towards di spot while authorities neva tok wetin cause di fire, according to local report.

According to official reports, di fire break out at 6:30 pm inside di emirate new industrial area in Ajman, wey dey some 50 km away from Dubai.

E no dey clear weda casualties dey for dis fire outbreak.

Fire fighters from civil defence stations in Dubai, Sharjah and Umm Al Quwain join Ajman force to battle di fire.

Di Ajman market na fruits and vegetables market for Dubai emirate new industrial area. Local report say di massive fire na sake of existing goods wey dey di market.

Some social media users don post short videos of di fire as e dey burn for Ajman market.

Wia Ajman dey for UAE and how close e dey in distance to main Dubai

Ajman dey located in United Arab Emirates. GPS Coordinates, 25° 23´ 58.2000” N 55° 28´ 46.5600” E. Latitude, 25.39950. Longitude.

Ajman (Arabic: عجمان‎ ‘Aǧmān) na di capital of di emirate of Ajman inside di United Arab Emirates, wey tanda along di Persian Gulf.

We still dey chook eye for dis tori, make you dey refresh dis page for more updates.