Lebanon explosion today: Casualty from Beirut explosion dey increase, Lebanese Red Cross tok – See world reactions

Lebanon explosion

EPA
Destroyed vehicles after di blast for di port of Beirut on4 August

Di death toll from Lebanon explosion on Tuesday don rise to at least 738 according to Lebanon health ministry, while 4,000 odas na im injure.

Di meeting of di Higher Defence Council, wey President Michel Aoun chair recommend say make di goment declare a two-week state of emergency inside di capital Beirut wen dem hold cabinet session on Wednesday.

Dis na wetin Beirut look like today afta Lebanon explosion

Lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images

Even before Tuesday tragedy, Lebanon wbin don already dey suffer under a number of major crises.

Di kontri currency don dey lose value against di dollar in recent months, leading to inflation and difficulties accessing basic goods.

On top of dis, Lebanon bin don dey deal wit major power cuts and oda problems over basic services.

Growing anger last year bin lead to mass protests against di bigcountry’s elite, which eventually toppled the government.

Coronavirus don also make tins worse.

Di goment bin implement strict lockdown which wey dem be relax for short period before dem reinforce am again.

How pipo dey react