BBNaija 2020 eviction: Nengi and Tolanibaj see me as competition – Ka3na

Ka3na, di first housemate to leave di Big brother Naija Lockdown season five show say Nengi and Tolanibaj see her as competition for di house.

Her fellow housemates nominate her for possible eviction on Sunday afta she land for bottom four from di votes from fans of di reality television show.

“We be three different women and no reason why we suppose get bad feeling or feel like I be threat to dem.”

Di Boss lady as she dey like to call herself tok dis one during her interview with BBC Pidgin on Tuesday.

https://www.facebook.com/watch/live/?v=2618467575082662&ref=watch_permalink

Ka3na wey be 26 year old lady from Rivers State south-south Nigeria bin dey very vocal inside di house and sometimes dat her character cause her to clash with some housemates for di house.

For di second week, she and Tolanbaj clash sake of food mata and dia gbas-gbos trend wella for social media.

“Dem just dey feel uncomfortable around me.” Na wetin she add put.

Ontop di lovey-lovey mata wey happun between her and Praise inside di house, she say dem no do kerewa but she call am her “cuddle partner.”

Ka3na dey tip Prince and Neo to win dis edition of di show. According to her, Prince dey smart and get a lot to offer.

Meanwhile Lilo di second housemate to live di reality television show say her relationship with her boyfriend dey ok even though she and Eric bin dey entangled inside di house.

She say she shock as Neo and Vee nominate her for eviction.

Lilo wey add say she and Eric no dey relationship and she ‘dey carried away’ for di house say her biggest lesson na focus.

Dis week, 16 housemates dey up for possible eviction out of di 18 wey still remain. Na only Ozo head of House and im Deputy Dorathy wey dey safe dis week.