BBNaija eviction: Ka3na, Lilo na di first Big Brother Naija lockdown housemates 2020 wey dem evict

Ka3na and Lilo don become di first two housemates to leave di Big Brother Naija season 5 lockdown house afta like two weeks wey im enta di crib.

Fans of di show bin put up Lilo, Eric, Praise and Ka3na for eviction out of di 18 housemates wey bin dey up for eviction dis week.

Among di 20 housemates, na only two no dey up for eviction- dat na di head of house Lucy and di pesin wey she select as assistant head of house, Prince.

According to di new method of eviction from Biggie house, each housemate go later come enta di Diary room to nominate one pesin among di four housemates wey fans put up for eviction.

Dis na di first time di organizers of Big Brother show dey introduce dis method for di history of di show.

See how di nomination waka

Brighto nominate Eric and Kat3na to leave

Nengi nominate Kat3na and Praise to leave

Ozo dey so emotional and reluctant to nominate and na from dia big brother gbab break for di nomination paro and di Host, Ebuka Obi Uchedu call out di names of di Housemates wey go leave.

Ka3na wey im full name na Kate Jones, na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria and she describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life.

While Lilo wey her real name na Boluwatife Aderogba na 23 years old dietician from Lagos, Nigeria. She be also entrepreneur and describe hersef as “a product of God’s grace”.

How fans react

Fans of di reality TV show dey react differently concerning di two female housemates wey comot today. While some dey thanks those wey vote for dia favourites odas don analysize di show.