BBNaija 2020 eviction: Ka3na and Lilo na di first two to leave Big Brother season five lockdown house

Ka3na and Lilo don become di first two pesin to leave big brother Naija season 5 lockdown house afta like two weeks wey im enta di crib.

Fans of di show bin put up Lilo, Eric, Praise and Ka3na for eviction before out of di 18 housemates wey bin dey up for eviction dis week.

Na only two pesin na im no dey ip for eviction- dat na di head of house Lucy and di pesin wey she select as assistant head of house- dat na Prince.

According to di new method of eviction from Biggie house, each housemate go later come enta di Diary room to nominate one pesin among di four housemates wey fans put up for eviction.

Dis na di first time di organizers of Big Brother show dey introduce dis method for di history of di show.

See how di nomination waka

Brighto nominate Eric and Kat3na

Nengi nominate Kat3na and Praise

Ozo dey so emotional and reluctant to nominate and na from dia big brother gbab break for di nomination paro and di Host, Ebuka Obi Uchedu call out di names of di Housemates wey go leave.

We still dey update dis tori as e dey happun