Lilo, Eric, Praise and Ka3na na di four pesin wey fans don put up for eviction for for di big brother Naija season 5 lockdown house afta like two weeks wey im enta di crib.
Out of di 20 housemates, 18 na im bin dey up for eviction dis week except di head of house Lucy and di pesin wey she select as assistant head of house- dat na Prince.
- Meet di housemates of Big Brother Naija lockdown Season 5
- See BBNaija housemates wey share first kiss in lockdown season 5
Fans of di reality TV show put up Lilo, Eric, Praise and Ka3na for eviction.
According to di new method of eviction from Biggie house, each housemate go later come enta di Diary room to nominate one pesin among di four housemates wey fans put up for eviction.
Dis na di first time di organizers of Big Brother show dey introduce dis method for di history of di show.