Big Brother Naija Season 5 Housemates: Praise and Ka3na ‘entanglement’ for bed shock fans

Big Brother Naija Lockdown housemates Praise and Katrina on Friday night cover head with sheets for bed, for wetin be like say dem dey do kerewa, as e show for videos wey dey circulate for social media. Plenti fans dey shock to see di two of dem do dat kind tin.

For two pipo to do kerewa for Big brother Naija house no be new tin but nobody dey expect Praise and Ka3na to join togeda for dat kain manner for bed.

See Why Pipo no expect Praise and Ka3na ‘Entanglement’

Fans say Praise and Ka3na no show any sign of relationship between dem.

Who be Praise Nelson?

Praise Nelson na 28-year-old dancer from Enugu and e no dey new to fame or competing. E be di winner for di K-Pop World Festival, South Korea 2015 and win third place for di national Dance Competition for 2010.

E be also fitness and personal trainer and certified Latin ballroom expert. Praise say im like meeting new pipo and im na life of di party.

Who be Kate Jones AKA Ka3na?

Kate Jones na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria. She describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life.

She say she want to dey famous, she like money wel-well and hate poverty. Her dream na to get di biggest luxury fashion brand for di world.

Di new season of Big Broother Naija start for July 19, 2020, and plenty tins don happun for di house.

BBC Pidgin go keep you updated on everytin wey dey hot for di house.