Nigerian soldier wey get depression shoot anoda officer dead for Bama, Borno

One soldier wey dey serve for 202 Battalion of 21 Special Armoured Brigade Bama for Borno State kolo and kill im fellow soldier on Wednesday, according to wetin di Nigerian Army tok.

Di tok tok person of di military say Sagir Musa say di incident happun for in front of di unit headquarters where di officer stand dey make call before di kolo soldier come shoot and kill am for dia.

Local tori pipo say di soldier wey die na Lieutenant Babakaka Shehu Ngorgi and im just marry but BBC Pidgin no fit independently verify dis informate.

But for di statement wey di military release, Musa say dem don arrest di kolo soldier and peace don return to di barrack. Also, di dead bodi of officer wey dem shoot don dey 7 Division Medical Services and Hospital.

“Investigation into di mata don start to determine di circumstances wey lead to the unfortunate incident.

“Di family of di dead officer don already know wetin happun. Di Nigerian Army sympathize and condole with di family for dis trying moment, and pray say Almighty God go grant im family and oda love ones di power to carry di loss,” na wetin Musa tok for di statement.