Boko Haram attack Governor Babagana Zulum: How di islamist group try to ‘kill’ Borno state govnor

Borno state goment confam to BBC say Boko Haram members on Wednesday attack Govnor Babagana Zullum convoy.

Tok-tok pesin to di Govnor Mallam Isa Gusau yan say di govnor escape di attack unharmed but some members of di govnor convoy including im security pipo sustain injuries.

Mallam Isa add say di Govnor bin dey on im way to Baga town wey dey for Munguno Local goment wen di attack happun.

How e happun

“Di tin happun on Wednesday after around 4pm wen di govnor dey try enter Baga town, e no even reach 1km from Kukawa town wey e first go na im dem start to shoot.”

“Di security pipo wey dey with am also start to return fire, before now, Nigerian Army bin tell di govnor say dem don collect Baga town from Boko Haram and di town dey under Nigerian army control now.”

“Di govnor dey unharmed and from dia e return to Monguno town after di incident.”

“Among govnor convoy, na only injuries happun, some members of di team crawl inside bush so dem get injuries and one police officer also get wounds.” Gusau tok.

Di islamist group dey worry well-well for di North east area of di kontri and tori be say dem don kill thousands of pipo and pursue many pipo from dia house.

Recently, dem kill four aid workers for di state, Di Govnor say “di victims die as heroes.”

Times Borno state don come under attack in di last one year

Dis no go be di first time wey Jihadists go attack di Nigerian north-eastern state, as ova di last ten years, attacks for di region don dey happun.

Since wen President Buhari enter office for second term wit promise to end di insurgency, attacks by di group for Borno never stop.

  • For May 2020, at least 17 pipo die and anoda 23 wunjure afta gunmen attack Gajigana village for Magumeri local goment area, Borno State.
  • At least 30 passengers bin die wen dem come under attack for Auno village wey no too far from di state capital for February 2020. Sources say insurgent attack and kill passengers wey bin dey stranded. Dem shoot and kill di victims wey include pipo wey dey leave for di area and travellers – odas burn beyond recognition. Dis na di second time wey di town come under attack inside 2020 afta di first one happun for January.
  • Askira-Uba local goment area bin come under attack for December 2019, afta jaguda pipo raid Rumirgo, Lassa, Mussa, Kufa and Chul villages.