Sam Smith and Burna Boy song ‘My Oasis’- See wen dem go drop di single

Ogbonge British Singer Sam Smith announce on Wednesday July 29 say im go release brand new single ‘My Oasis’, wey go officially come out on Thursday (July 30) by 7.20pm BST, di single go feature Nigerian superstar Burna Boy.

For Burna Boy dis collabo dey come afta di Jerusalema remix with Master KG for June.

Smith post black-and-pink video of di instrumentals of di song with di Nigerian singer for social media.

https://www.instagram.com/p/CDPKdqSAO7x/

Dis go be im first new song since im release duet with Demi Lovato ‘I’m Ready’ for April.

Tori be say e dey come ova one year since im release di song ‘How Do You Sleep?’, wey bin suppose appear for Smith upcoming album wey im postpone.

‘Money On My Mind’, ‘Stay with Me’ and di Spectre dem song ‘Writing’s On the Wall’, wey win Oscar in 2016 na some of Sam Smith hit songs.

Di British singer dey worth an estimated £33m.

How fans react to Sam Smith collabo with Burna Boy?

Fans dey hail Burna Boy for di latest collabo with Sam Smith. Even though dem neva release di song, some of dem believe say e go be hit.

Di British singer tweet say “so much love for you Burna. Dis go be fun”.

Burna reply am back say you “killed it Sam.”

See some od di fans reaction

Dis no be first time wey Burna dey collabo wit foreign musicians, e don make music with Beyonce, Stormzy and Ed sheeran.