Gas explosion in Ajao Estate Lagos: Three pipo die for Nigeria city neighbourhood

Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC

Gas explosion in Ajao Estate Lagos kill at least three pesins and plenti odas injure on Tuesday evening for one shop near roll of 12 shops inside Palm groove area.

According to eye witness, di explosion happun wen one customer bin come buy gas from one woman wey don close shop for di day but she gatz reopen to sell before e kill her.

Authorities inside Lagos, wey be Nigeria bizness capital tell BBC Pidgin say dem don recover two deadi bodi from wia di explosion happun for di mainland area of di city wey near di main airport.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/335086634173823

One man wey survive di explosion but e no gree make we call im name say: “Around 6:50PM wey I go my friend boutique na me hear one loud sound like bomb blast.

Di zinc and everitin wey dey around collapse. I force mysef rush out, pull di glass and I come injure for hand. Di woman wey dey sell di gas and her daughter die, then one tailor very close to di place die too. Di cause of everitin na di tricycle rider alias marwa driver wey come buy gas. E hit di gas as dey try to reverse, na im everything come explode.”

Chairman of Liquified Petroleum Gas retailers Lagos chapter, David Okenwa, tell BBC say dem come di scene of di explosion to let di public know say no be cooking gas explode.

E say any oil wey touch oxygen cylinder na instant explosion and e find out say di woman wey get the store wey di explosion for happun dey sell oxygen, cabad, oil and Oxycytelene combine togeda.

Many pipo injure wen di explosion happun around 7PM, pesin wey arrive afta e happun tell BBC Pidgin.

Dem don rush pipo wey wound go hospital anoda eyewitness tok.

See fotos gas explosion in Ajao Estate Lagos

Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC
Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC
Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC
Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC
Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC
Gas explosion in Ajao Estate Lagos

BBC

Gas explosion don kill many pipo for Lagos Nigeria wey get over 20 million population.

How Reverend Sister Henrietta lost her life saving odas from Lagos explosion
The British Broadcasting Corporation
Lagos Explosion: How secondary school owner, wife die for Lagos explosion
The British Broadcasting Corporation
How Reverend Sister Henrietta lost her life saving odas from Lagos explosion
The British Broadcasting Corporation