Toke Makinwa react to tori say Amcon seize her Banana Island house

“We Move” na di two words wey Toke Makinwa tweet on Monday as tori begin fly upandan say di popular radio personality for Nigeria lose her Banana Island house to Amcon.

Although BBC Pidgin no go fit verify, some fans and Twitter users react ontop di mata dey claim say Toke Makinwa house na Festus Fadeyi, di Chairman, Pan Ocean Oil Corporation, wey get 240 billion naira gbese to settle wit Amcon na im get di house.

However Toke Makinwa, through her image makers don tell local tori pipo and any pesin wey care to know say di Asset Management Company of Nigeria (AMCON) no sieze her house for Ikoyi, Lagos.

According to local tori, Toke Makinwa publicist deny di rumours insisting say na di popular radio personality na im be only owner of di property.

Dis statement land few hours after social media catch fire ontop reports say di celebrity house na AMCON seize.

AMCON work na o settle non-performing loan assets. Local Tori pipo tok say AMCON lock di house sake of debt wey dey ontop di house.

Asset Management Corporation of Nigeria (AMCON) na di Nigerian office wey dem establish by Act of di National Assembly of Nigeria for July 2010 wit a plan say e go stay for 10 years lifespan.

See as Nigerians bin react

Toke Makinwa however pas some coded message for retweets

Toke Makinwa na controversial Nigerian celeb and di last time wen she trend na just days ago wen she tok say Marriage get expiry date.

Na on 3 November, 1984, dem born Toke Makinwa and apart from being a Nigerian radio personality, she also be television host, vlogger and lifestyle entrepreneur.

She dey popular for hosting The Morning Drive on Rhythm 93.7 FM and for her YouTube vlog series Toke Moments.

Toke Makinwa: “Money no dey for dis job o, but you go get exposure”
The British Broadcasting Corporation