Flood in Abuja: Gwagwalada, Suleja flood kill pipo, sweep houses in overnight heavy rain fall for parts of Nigeria capital city

Gwagwalada, Kuje flooding sweep pipo in overnight heavy rain fall for parts of Nigeria capital city, according to local reports.

Tori be say na on Saturday di rain wey fall over night cause flood parts of Abuja, authorities inside di Federal Capital Territory don confam give local tori pipo.

Pipo fit don die from di flood according to local reports.

Di heavy flooding kill a family of five and swallow over 20 buildings in Gwagwalada area council of Abuja on Saturday. The Cable dey report.

For Suleja, (a boundary community between Abuja and Niger State for north central Nigeria) one pregnant woman die with four of her children along with five other persons in heavy flood after one early morning rainfall on Saturday. Daily Trust dey report.

Idriss Abbas, di Director-General of Federal Emergency Management Agency (FEMA), say di body of one of di missing family members dem recover am while search dey on for di remaining four.

“Gwagwalada dey flooded from Giri. One family of five na im di flood sweep throway for Giri. We get one deadi bodi and dey search for four. We rescue six pipo and dey dey hospital,” Abbas tok.

Di flood start from Friday night to di early hours of Saturday also cover Gwagwalada bridge linking Abuja to Lokoja for Kogi State north-central Nigeria.

Motorists gatz by force take different route while odas park to wait for di flood to reduce

Some residents of di area, according to tori, tok say flooding dey common inside di community because of how e dey close to river.

Flood in Abuja: How pipo react

We still dey chook eye for dis tori, abeg refresh di page for more updates.