Third Mainland Bridge Lagos: Gov. Sanwo-Olu advise Lagosians to use water transport routes, terminals to avoid 3MB road traffic

Third Mainland Bridge Lagos partial closure effect go show red on Monday and oda week days wen many of di over 20 million Lagosians go comot from dia house enta road to find alternate route to dia daily hustle afta authorities shut di longest bridge in di city for repairs wey federal goment say go last for six months.

Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don announce say im go soon launch six new jetty as im encourage Lagosians to consider water transport for di next 3 months.

Dis dey come as di federal goment of Nigeria no change mouth about di third mainland bridge repair work wey dem say go begin on 26 July.

Third Mainland Bridge: “We dey check weda di joints don expire”
The British Broadcasting Corporation

How to move for Lagos wit ferry

Few months ago for February 2020, Lagos announce say Gov Sanwo-Olu launch LagFerry mobile app to allow pipo take advantage of waterways for Africa most populous city. Although, we no see evidence of di app ontop Apple Appstore and Google Playstore.

Currently Lagos get about 30 routes:

  • Ajah – Five Cowries – Marina/C.M.S
  • Badore – Five Cowries
  • Badore – Ijede
  • Baiyeku – Ajah
  • Baiyeku – Victoria Island
  • Ebute Ero – Ikorodu
  • Ebute Ojo – Ijegun Egba – Marina C.M.S
  • Ijede – Marina C.M.S
  • Ikorodu – Addax/Falomo
  • Liverpool – Igbo Elejo
  • Liverpool – Olodi Apapa
  • Marina/C.M.S – Ikorodu
  • Baiyeku – Langbasa
  • Ebute Ojo – Ibasa
  • Ebute Ojo – Ijegun Egba
  • Ebute Ojo – Irewe
  • Ijegun Egba – Ibasa
  • Liverpool – Five Cowries
  • Marina/C.M.S – Liverpool
  • Agboyi Ketu – Five Cowries
  • Agboyi Ketu – Marina/C.M.S
  • Agboyi Ketu – Mile 12
  • Ajah – Oworonshoki
  • Ijora – Ebute Ero
  • Ikorodu – Oworonshoki
  • Marina/C.M.S – Oworonshoki
  • Mile 2 – Addax/Falomo
  • Mile 2 – Marina/C.M.S
  • Oworonshoki – Ebute Ero
  • Oworonsoki – Five Cowries

Cost of ferry tickets range from like N500 ($1.29) to N1000 ($2.59). For complete breakdown, see dis informate direct from Lagos State Twitter account:

Third Mainland Bridge closure Lagos

BBC
Third mainland bridge wey empty

Alternative ferry service

Many pipo for Lagos don dey fear say traffic wey di closing of di bridge go cause, especially during week days, go tie wrapper.

Dis fit be why di govnor, through im tok-tok pesin Gboyega Akosile, tok on 25 July say make “commuters explore how to use waterways as faster alternative.”

Although na one lane (island to mainland) of Africa second longest bridge go dey closed for di first 3 months, pipo don begin experience di kain heavy traffic wey e fit cause around di city.

For instance, journey wit vehicle from Ikoyi go Anthony wey on a normal day no suppose pass 30 minutes, one BBC journalist say over di weekend, im spend over 2 hours for.

So waterway fit be solution for some pipo to avoid traffic?

Some commercial private companies dey operate dia own ferry service, like di one from car hailing company Uber wey dem call UberBoat.

UberBoat: How e dey operate for Lagos
The British Broadcasting Corporation

And one company even ready to use sky to transport pipo over di traffic with dia helicopter service. Although e no dey dey clear if na service wey everyday pipo go fit use as we hear say di money for one trip enta thousands of dollars!