NIPOST new Licence Fee: Why Nigeria Postal Service increase license fee and how e fit affect you and your business

Di Federal Government don reject di proposed increment of license fee for courier services by di Nigerian Postal Service, NIPOST.

Di minister of communication and digital economy, Isa Pantami, inside tweet on Saturday morning, tok say di increase no dey part of di regulation wey im approve for di agency on Friday, July 24.

Im add say dem tell NIPOST chairman and Post Master General “on (Friday) to put di implementation on hold and send report to dia ministry by Monday.”

Di proposed license fee increase wey go make di cost of courier service go up for di kontri don cause plenti gbas-gbos as Nigerians dey para for social media.

Why NIPOST increase License fee?

According to NIPOST, companies wey dey provide international courier services like DHL, UPS and FEDEX, go pay N20m for new licence and N8m every year for renewal.

Companies wey dey offer services within di kontri go pay N10m for licence and N4m yearly for renewal.

Di Nigerian Postal Service say di new regulations wey dem put in place na to protect genuine courier and logistics operators and send out pipo wey no dey registered.

NIPOST tok-tok pesin Franklin Alao, inside statement wey dem release to di NPO Reports late Friday night say genuine business owners wey sabi wetin di logistics business be, no go dey part of di pipo wey dey protest against di new regulations.

“Di new regulations no be to frustrate ease of doing business but to promote di growth of MSMEs. E go create a sense of sanity, consumer-service provider trust, Alao tok am for di NPO Reports.

He tok say di Ministry of Communications and Digital Economy give di new regulations wetin dem call “serious considerations before dem conclude on those charges and di need to categorize di operating license.”

He add am say, “Na part of di strategies to ensure effective service delivery as consumers go fit sabi di capacities of di operators wey dem dey deal wit.

Plenti pipo don enta social media to condemn di new regulations. Dem tok say e dey too hash and e fit drive small businesses comot from market.

How e go affect individuals and businesses?

Sake of di coronavirus pandemic and lockdown measures for di kontri, most small businesses now dey survive on logistics and delivery services.

If moni for courier services increase, e mean say di cost of goods and services go increase.

Consumers go dey forced to pay more for goods and services sake of delivery cost.

And e dey likely say di way pipo dey order for goods and services fit reduce if di cost too dey high.

Pipo wey also dey into logistics fit suffer di down effect of losing dia jobs if pipo no too dey order for goods and services.