Big Brother Naija season 5 wey pipo don dey wait for since don begin today as di 20 housemates wey go stay inside di ‘lockdown’ house for 10 weeks enta di crib afta 14 days quarantine wey dem bin dey sake of di coronavirus pandemic.
- See di billionaire pikin wey dey contest BBNaija 2020
- See events wey go happun for BBNaija House dis weekend & why fans dey drag Nengi, Head of House
- Meet di first Head of House BBNaija 2020 housemates
- Ibadan lady ‘dehumanization’ suspects inside police viral video don chop arrest
- How Dorathy Instagram ‘blow’ afta BBNaija show launch
- Laycon BBNaija 2020 housemate na Unilag Best Graduating student
- Evritin you need to know about Big Brother Naija season 5
- Kanye West Kim Kardashian update
- See wen Nigeria Aviation minister say international flight go resume for di kontri
Among di new housemates na; Dietician, singer Uber Driver and odas.
Ozoemena Chukwu AKA Ozo
Ozoemena wey be 27 years old na Consultant and entrepreneur from Imo State. One of im greatest achievements na to work with UEFA Federation for Europe.
E study Economics and like to dey play loud music in di morning and to dey bang on doors.
- Nigerian Air Force don begin dia 2020 recruitment – Follow dis steps to apply
- How to apply for N75BN Nigerian Youth Investment Fund
Victoria Adeyele AKA Vee
Victoria Adeyele wey be 23 years old na musician wey base for Lagos, Nigeria. Dem born and raise her for London and she move come Lagos almost one year ago to begin her music career.
She say her parents na Nigerians and say she dey enjoy acting, socializing and making pipo laugh. Vee say she no eva don dey relationship wey last longer than six month.
- Chicago prison release Hushpuppi? – See wetin we know so far
- Ibadan lady ‘dehumanization’ suspects inside police viral video don chop arrest
Nelson Enwerem Prince
Nelson Enwerem Prince wey be 24 years old na entrepreneur from Abia. E don do modelling, fashion designing plus interior decoration and na graduate of pure physics from the University of Calabar.
Prince say im like to dey ignore pipo knowingly and like working out, swimming, food and reading about ancient religions and African history.
- How to apply for N75BN Nigerian Youth Investment Fund
- Nigerian Air Force don begin dia 2020 recruitment – Follow dis steps to apply
- NDDC abandon 23.5km road project connecting Bayelsa and Rivers State?
Boluwatife Aderogba AKA Lilo
Boluwatife Aderogba na 23 years old dietician from Lagos, Nigeria. She be also entrepreneur and describe hersef as “a product of God’s grace”.
Lilo say her biggest achievement na starting her own brand.
- Dorathy instagram ‘blow’ afta BBNaija show launch
- Laycon BBNaija 2020 housemate na Unilag Best Graduating student
- Big Brother Naija Season 5 – See wetin make am dey different from oda seasons
- Five cool tins to know about Ebuka Obi-Uchendu, Big Brother Naija Season 5 show host
Timmy Sinclair AKA Trikytee
Timmy Sinclair na 35-year-old creative artist from Bayelsa State, Nigeria. E consider himsef as a storyteller wey dey uses di mediums of film, and music to express himsef.
Tricky Tee say im na pesin wey no fit into society and e dey too kpako to be butty plus im like food.
Lucy Essien
Lucy Essien na 30-year-old entrepreneur from Cross River. She say she be simple girl not so average and can dey mean and rude if pesin step on her toes.
Lucy say she believe in fairy tales, like good food and like her space.
- NDDC abandon 23.5km road project connecting Bayelsa and Rivers State?
- How to apply for N75BN Nigerian Youth Investment Fund
- Nigerian Air Force don begin dia 2020 recruitment – Follow dis steps to apply
Terseer Kiddwaya
Terseer Kiddwaya na 27 years old self-employed man wey come from Benue State. E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated.
E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling.
- See di billionaire pikin wey dey contest BBNaija 2020
- See how pipo survive Third Mainland Bridge closure in 2008, 2012, 2018 & now
Dorathy Bachor
Dorathy Bachor na 24-year-old entrepreneur from Delta State and she believe she be di only one wey fit make you smile.
She say her biggest achievement na SHOPFORME – dat na di biggest procurement company inside Nigeria.
Praise Nelson
Praise Nelson na 28-year-old dancer from Enugu and e no dey new to fame or competing. E be di winner for di K-Pop World Festival, South Korea 2015 and win third place for di national Dance Competition for 2010.
E be also fitness and personal trainer and certified Latin ballroom expert. Praise say im like meeting new pipo and im na life of di party.
Florence Wathoni Anyansi
Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time
She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo.
- See how pipo survive Third Mainland Bridge closure in 2008, 2012, 2018 & now
- Police recruitment login dey hard for you to apply? See wia to complain
- Nigerian Air Force don begin dia 2020 recruitment – Follow dis steps to apply
Tochukwu Okechukwu AKA Tochi
Tochukwu Okechukwu na 28-year-old rapper and real estate agent from Imo state. E say e dey live and breathe entertainment and of Education chemistry
E say im dey straight forward and na social pesin. Im biggest achievement na to dey independent and to get education.
Kate Jones AKA Ka3na
Kate Jones na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria. She describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life.
She say she want to dey famous, she like money wel-well and hate poverty. Her dream na to get di biggest luxury fashion brand for di world.
Eric Akhigbe
Eric Akhigbe na 24 years old final year student for University of Lagos and come from Edo State. E say im na pipo pesin and dey get pleasure if e complete any task
E describe himsef as fun, e like competitive sports and like fitness well-well plus also enjoy winning.
Ngozi Nlewedim AKA Erica
Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London.
She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone.
Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
Ezekiel Bright Osemudiame na 29-year-old sailor from Edo State. Brighto say e be di youngest of six kids and get degree in Marine Engineering from Arab Academy for Science Technology and Maritime Transport inside Alexandria, Egypt with plenti oda professional certifications. Im biggest achievement na scholarship wey im get to study abroad plus also im third engineer license including oda professional certificates.
E say e no like to dey offend pipo and e can speak Ibo, Hausa, Yoruba, Edo plus little bit of Arabic. e like to dey swim, travel and like adventure.
Aisha Umaru AKA Kaisha
Aisha Umaru na 25-year-old entrepreneur from Sokoto state. She consider hersef great team player wey dey get along with pipo. She rely on healthy diet.
She say she can be dramatic sometimes but very emotional. She like singing, going out and having having fun.
Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
Emuobonuvie Akpofure na 26 year old ride-hailing app driver from Delta State . E describe imsef as fun, tolerant, loving and smart. E also dey secretive.
E biggest achievement na wen im win N 500 000 from one talent competition. E say e like wen pipo dey underestimate am and call imsef problem.
Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
Tolani Shobajo na 27-year-old media personality from Lagos state. Tolani na energetic gingered babe. Pipo always call her di life of di party.
Tolanibaj say she come di house for di money, she like money and she like Naira Marley.
Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. E be graduate of philosophy from University of Lagos. E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata.
E biggest achievement na im song ‘Fierce’ wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months.
Rebecca Hampson AKA Nengi
Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures.
She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef.
Oda tori dem wey you fit like:
- Nigeria Police on how many recruits dem wan employ – Check how e affect you wey apply
- NDDC boss collapse for probe hearing
- Nigerian schools resumption update from ASUU
- Nigeria schools resumption latest update on Waec examination
- Scavengers wey dey risk Covid-19 to keep Abuja clean
- See wen Nigeria Aviation minister say international flight go resume for di kontri