Mali crisis: President Buhari, Goodluck Jonthan, Ecowas peace mission to Bamako no still fit solve di political crisis – Dis na beginners guide to understand di palava inside dis West African nation

Anoda round table discussion by di West African regional body ECOWAS to find solution to di political crisis for Mali don end wit no deal between di goment and di opposition.

Opposition coalition want make President Ibrahim Boubacar Keita resign say im goment don fail to improve di security situation for di kontri.

Five presidents from five West African bin hold talks wit di political actors for Mali on Thursday to settle di mata but dem no gree. Di opposition coalition wey one popular Islamic cleric Mahmoud Dicko dey lead reject di proposal say make dem form a national unity government.

Di opposition tanda for dia ground say President Ibrahim Boubacar Keita must step down and make dem put in place interim government. But di regional body ECOWAS don cancel dat option dem say any change of goment must follow wetin constitution tok.

Mali political crisis: ECOWAS Peace Mission in Bamako Mali

Reuters
Some pipo dey call for President Keïta to resign

ECOWAS don announce say anoda extra ordinary summit wey go include all di heads of state for di region go hold on Monday.

Di head of ECOWAS and president of Niger, Muhammadou Issoufou say dem go use strong hand take help solve di crisis for di extra ordinary summit.

Di latest visit by di presidents of Niger, Nigeria, Ghana, Senegal and Ivory Coast no yield any positive result just like di efforts wey di region don do wey no dey successful.

Jonathan na im Ecowas appoint to bring peace to Mali

Economic Community of West African States (ECOWAS) don appoint Jonathan as special envoy to Mali to help bring peace to di political crisis wey dey worry di kontri.

Dem dey expect president Jonathan to discuss wit di main political actors for di kontri including President Ibrahim Boubacar Keita and top religious leaders in order to solve di problems.

E no too tay wey Mali enter political crisis wia recent protest by some pipo dey call on President Keita to step down from im position over issues wey dey trouble di kontri and im election wey dem say no dey fair.

Former Nigerian President Goodluck Jonathan on Monday pay courtesy call on President Buhari for im villa for Abuja, wia dem hold private meeting.

Buhari’s Twitter account reveal say Jonathan visit Aso Rock Villa to report on di political crisis resolution mission wey ECOWAS send dem to Mali last week.

“I don receive report from Ecowas’ special envoy to Mali, former President Goodluck Jonathan, on di political crisis wey dey happun for Mali and we go ask di group president, di President of Niger, to give us full account of im presidency,” Buhari tok.

Wetin dey cause di political crisis for Mali

President Ketha dey face wetin many experts dey call di biggest political problem e don get since e take over goment for 2013.

Opposition politicians and protesters want make im step down, say im administration don fail to address militants and al-Queda wahala for di kontri.

Dem also claim say di kontri dey face economic crisis under im goment and di election wey am to power no pure.

Many pipo protest for Mali

AFP
Many pipo protest for Mali

Thousands of pipo don protest and di demonstration don lead to death of some protesters wey do I no gree to President Keita and want make e resign.

Dem first elect 75 year old Oga Keita as Presient for 2013. Then he secure anoda five year second term for 2018.

But e dey under pressure sake of di kontri economic crisis, coronavirus, strike, jihadist wahala couple with corruption accuse wey dey im neck.