Southern Kaduna attacks: President Buhari say Kaduna killings dey more complicated than wetin pipo think

Nigeria President, Muhammadu Buhari react to di kill-kill wey dey happun for southern Kaduna State, say e dey complicated pass wetin plenti pipo dey tink.

For inside statement wey di presidency release, di Nigerian leader tok say political jaguda pipo get hand for di problem for Southern Kaduna.

For di statement Garba Shehu wey be di Senior Special Assistant to di President, Media & Publicity release, dem highlight revenge killings and mutual violence by criminal gangs acting on ethnic and religious grounds as part of di factors wey make di attacks dey spread more and more.

“Na di kain situation wey one criminal group go kill one member of anoda criminal group sake of ethnic and religious motivations and e don lead to revenge and counter-revenge, and e dey make di job of di security personnels wey goment deploy to di area to protect dia lives dey more difficult,” di statement tok

Di presidency, don however warn residents make dem stop to dey take laws into dia hands say e dey make di work of security pipo more difficult.

How di Southern Kaduna Kill-kill start?

E no dey clear wen di first report of killings happun but clashes between di Christian community and di Muslim community for Kaduna na age long fight.

Farmers-Herders clash on top land ownership na anoda fight-fight wey dey happun for di area and most times e dey result to violence and loss of lives.

See di major kill-kill wey don happun for Southern Kaduna since President Buhari enta office

For May 2018– Police report say at least 45 for one attack for one retaliatory attacks by armed bandits for Gwaska village in Birnin Gwari, Kaduna State

Kaduna State Commissioner of Police Austin Iwar tell tori pipo for CNN say “Di vigilante group din kill some bandits two weeks before, so Saturday na reprisal attack by di bandits wey enta di village and begin shoot everybody”

Women and children dey among di pipo wey dem kill as di jaguda pipo open fire on women and children for di farming settlements area.

For October 2018, anoda attack happun between Christians and Muslims for Kajuru, 55 pipo die for di attack, 22 children, and 11 women dey among di victims.

According to reports, wetin cause di October 2018 attack na one market quanta wey lead to di death of two pipo.

President Muhammadu Buhari condemn di attack.

For 10-11 February, 2019, di popular 2019 Kaduna state massacre happun some hours before di Nigerian general election. Di state governor, Mallam Nasir Elrufai say jaguda pipo kill 141 pipo for di Kajuru LGA of di state. Diethnic fight claim 11 Adara pipo and 130 Fulani.

However di Fulani group Miyetti Allah report say na 131 Fulani pipo die for di attack.

Local pipo wey dey on ground bin claim say di killings happun as part of revenge for clashes in October 2018 between Christians and Muslims in Kajuru wey kill 55 pipo.

Some days later, Fulani herdsmen attack Ebete of Agatu LGA of Benue State and 17 pipo die for di attack.

For 26 February, 2019 report comot say at least 29 pipo die for attack for Karamai community of Kajuru. Di suspects of di attack na Fulani pipo as revenge for attack on Fulani settlements.

Di governor confam few days later say di death toll don rise to 40.

March 2019, some jaguda pipo wey dem no fit identify ambush and kill 17 vigilantes for one Birmin Gwari area of Kaduna state and dem tiff dia cattles.

For di same month, 10 pipo die for Nandu-Gbok village of Sanga LGA afta one attack by suspected Fulani herdsmen. Pipo wey dey live for di area suspect say na revenge attack wen some community members attack and kill least 11 cows and 28 sheep wey belong to di herdsmen before di election.

For 2020, di attack continue as fresh attack happun on 20 July for Kukum Daji Village of Kaura local governmnet, atleast 19 pipo die and 31 pipo wunjure

Di President of di community, Yashen Sunday Titus tell confam give tori pipo for Daily Post say di incident happun wen wen dem attack di victims for one wedding party.

Yashen add say some of di villagers still dey miss.

E no dey clear wetin be goment strategy to put an end to di incessant killings wey don claim plenti lives for di area but President Buhari tok for statement wey im release for July 21, 2020 say ” wetin dey required na for di local authorities to radically improve dia intelligence capabilities make dem for fit alert security agencies on any planned attacks”.