Third Mainland Bridge closure Lagos: FG dey close TMB by midnight Friday, find di latest alternate routes here

Third Mainland Bridge closure

BBC
Di Federal Controller of Works in Lagos say road rehabilitation wey dem dey carry out no go stop di maintenance wey federal goment wan do on top third mainland bridge, therefore no need to extend di closure date.

Third Mainland Bridge closure dey go ahead as goment plan and no going back or postponement go happun, na wetin Federal Controller of Works in Lagos, Olukayode Popoola tell BBC Pidgin on Wednesday.

Di Third Mainland Bridge closure go take effect from midnight on Friday 24 July, 2020 to begin scheduled rehabilitation work to ensure say di second longest bridge in Africa no collapse.

However di big kwesion wey dey many of di over 20 million pipo wey dey live in Lagos, Nigeria commercial capital na weda di goment don dey ready for dis closure?

Oga Popoola tok say dem no go extend di closure of thdi third mainland bridge as di maintenance and rehabilitation work wey dey go on for di alternative routes wey di state goment dey arrange don dey ready and dey still dey work on some.

Di Federal Controller of Works in Lagos add say Addo/Oyingbo/Adekunle/Ebutte Metta roads don dey ready, say Lagos state goment do overlaying for di road.

Ikorodu road to Maryland too don dey ready as di Federal Road Maintenance Agency do road surfacing for di road, Popoola add.

Di Federal Controller of Works for Lagos State, Olukayode Popoola tok say dem no go extend di closure of the third mainland bridge as the maintenance and rehabilitation work wey dey go on for di alternative routes wey di state goment dey arrange don dey ready and dey still dey work on some.

Lagos Waste Management Authority don tok say no need for panic about ontop di partial closure of di bridge as one lane go dey available for movement at peak times.

Oga Popoola say Addo/Oyingbo/Adekunle/Ebutte Metta roads don dey ready. Lagos state goment do overlaying for di road

Ikorodu road to Maryland for Laagos too don dey ready as di Federal Road Maintenance Agency do road surfacing for di road.

Di Lagos State Ministry of Works and Infrastructure tok say di ministry go close down Oworonshoki bound carriage way first for three months and afta dem complete di work dem go move go Island for more repair works.

Third Mainland Bridge closure

BBC
Goment say dis na one of di areas wia dem don already plan to repair

On top di traffic situation, e say dem dey follow LASTMA tok on how dem go fit reduce traffic and advise make road users dey patient and obey all di traffic rules.

Traffic Situation Report – Lagos Reporter, Gift Andrew

Di koko be say traffic situation don bad pass before for routes wey lead from Lagos mainland to di island, dis na sake of say goment close Eko bridge to do repair work on am.

Pesin wey from Ojota area dey go Lagos Island through Ikorodu road dey now spend like three to four hours on di road wey suppose take am 30 to 45 minutes on a normal afternoon.

We see say repair work dey go on for Ojota, Ikorodu road, Eko bridge while dem dey do final touch for Costain bridge.

Di third Mainland Bridge wey be di major cause of dis whole situation also witness traffic jam even by Wednesday afternoon.

If dis kain traffic jam don dey worry di city now wey dem close only Eko bridge, who know wetin go happun if dem close third mainland bridge on Friday.

BBC Pidgin go round some of dis routes and discover say dem don already fix di bad spot wey dey Maryland, ongoing repair works dey happun from Maryland to Onipan.

Ongoing repair work for Maryland

BBC
Ongoing repair work for Maryland

Repair work at Maryland

BBC
Repair work at Maryland
Traffic at Ikorodu

BBC
Traffic at Ikorodu

Di Special Adviser to Lagos state govnor on works Aramide Adeyoye say dem don map out ten major alternative roads wey pipo go fit dey use afta dem close down di bridge.

She complain for di many bad roads wey dey di state and say na di plenty dirty wey residents dey put for gutter dey cause am.

Road rehabilitation

BBC
Road rehabilitation
Third Mainland Bridge closure

BBC
Heavy traffic for Third Mainland Bridge