Woodberry: Court dismiss case against Olalekan ‘Woodberry’ Ponle

Court for America don trowey di matter wey dem file against Nigerian, Olalekan Ponle, aka Woodberry wey Dubai police bin arrest for internet scam.

According to local tori Premium Times, di US court throwey charges against Woodberry and make dem no hold any bad tin against am.

Police for Dubai arrest Ponle along with Ramon Abbas a.k.a Hushpuppi for Dubai on 10 June and later carry dem give United State goment wey con dey prosecute dem for internet fraud, wey Nigerians dey call yahoo-yahoo.

According to document wey BBC Pidgin torchlight, di Judge Robert W. Gettleman on Tuesday grant di motion to dismiss di charge.

“Goment motion to dismiss complaint without prejudice [17] don dey granted. without objecton di complaint against defendant Ponle don dey dismissed without prejudice,” na wetin Judge Gettleman tok according to document wey BBC Pidgin see.

Dis new development dey in line with US Federal Rules of Criminal Procedure 48 wey allow make goment throwey charges wey dem don charge against person.

But dis one no mean say Woodberry be free man as e fit get oda charge ontop im head.

According to di analysis of di court statement wey BBC Pidgin bin get from one Nigeria Lawyer, Adetokunbo Eribake Esq., di statement fit mean two tins:

‘E fit mean say di two parties dey discuss ontop how to settle out of court or arrangement with di Government bin dey to dismiss di action against Woodberry.

Or e fit mean say fresh facts don show wey go require make di State withdraw di charge against Woodberry, and refile.

However, di fact say di court withdraw di charge without prejudice means say di state fit refile anoda action for court’. Eribake tok

According to di informate on di Federal Bureau of Prisons (BOP), Ramon ‘Hushpuppi’ Abbas no dey di Chicago prison where dem be hold am before.

However, Hushpuppi lawyer Gal Pissetzky tell local media say na only transfer dem transfer im customer from Chicago go California, no be say na free man im be.