One of Big Brother Naija housemate, Aisha Umaru popularly known as Kaisha for di house burst into crying inside di diary room on Wednesday wen she dey follow Big brother tok one-on-one.
For wetin be like say di housemates no go fit take di heat afta just two days , Kaisha complain say fake pipo too plenti for di house.
- Meet di housemates of Big Brother Naija lockdown Season 5
- See di billionaire pikin wey dey contest BBNaija 2020
Wen di voice of di Big Brother ask am about wetin be her opinion about oda housemates and how she dey follow dem yarn.
“Dey are all fake, Big Brother, dey are all fake, today dis pesin dey nice to you, tomorrow di pesin no go dey nice to you.” she complain.
“They are all fake!” -Kaisha. Is she right or is she playing #BBNaija wrong?🤓https://t.co/PAtsVjNWEO
#BBLiveBlog pic.twitter.com/BeS7EJYjjV
— Big Brother Naija (@BBNaija) July 22, 2020
Wit 10 weeks to go for di lockdown edition, hope be say Kaisha go fit cope long enough to stay all through di edition to become winner of di season 5 edition.
Who be Kaisha
Aisha Umaru na 25-year-old entrepreneur from Sokoto state. She consider hersef great team player wey dey get along with pipo. She rely on healthy diet.
She say she can be dramatic sometimes but very emotional. She like singing, going out and having having fun.
How pipo react to her cry-cry
Keisha needs her mommy 🤣🤣
Girl is slooooooooow…….#bbnajia2020 pic.twitter.com/l3Il2Z4WUH
— Adedoyin🔥🔥 (@SexyDoyin1) July 22, 2020
2 days in and keisha is already sobbing, jesu!!#BBNaija pic.twitter.com/NF2u97FTHf
— Virgo97♍ (@SqhamoKatywa) July 22, 2020
Keisha : everybody is fake
Big brother low key : who be this one
#bbnajia2020 pic.twitter.com/OQLf2LMsVP
— #Team Laycon (@dami_dre) July 22, 2020
Kaisha is lucky she didn’t make pepperdem squad #bbnaija #bbnlockdown pic.twitter.com/aZXHCf0Ud7
— who’s your grandfather? (@jidenne) July 22, 2020
Isn’t it too early in the morning to be looking at fake housemates in this manner Kaisha?😂🤣 #BBNaija pic.twitter.com/82btJgAQLA
— NNEKaTA (@madamneka) July 23, 2020